Senior Pastor leave eim church for assistant pastor while eim go to Portharcourt for three months. Before di senior pastor come back, di assistant pastor don give eim pikin belle and run away with di church money.
Ontop #ourbackyard with Nedu and Tombo, Neighbor house wey mama dey keep her 4 year old girl, Dem come rape di girl front and back.
For #ourbackyard wit Nedu and Tombo, one woman tok say she meet her boyfriend for Instagram for 2018, say she tell di boyfriend say she no wan anybodi wey go break her heart, na so di boyfriend chop almost 1 million of her moni.
One 39 year old woman call ontop #ourbackyard wit Nedu and Tombo say di last time wey man toast am na for 2016, say since then no man don toast am talk more of marriage.
Ontop #ourbackyard wit Nedu nd Tombo woman call say her husband no dey sleep with am, say eim thing no dey stand, she come later find out say her husband like to dey torchlight man.
Whitemoney tok say even though pipu dey laugh am say e no sabi sing. When eim commot big brother, Big brands come buy di songs wey eim do for big brother house.
Girlfriend tell her boyfriend say she get belle, di boyfriend come tell her make she go abort di belle. She come try to do di abortion but e no work. Na so di boyfriend go meet di girl family. Afta she born na so di man no wan to dey take responsibility of d pikin.
Woman wey born three children with her boyfriend of 11 years tok say her boyfriend dey always beat her even wen she get belle.
Bcos of small quarrel , wife carry her 3 pikin commot for her husband house!!
As she no gree help her husband pay house rent em won drive her wit her pikin dem commot for house
Golden come tok say her papa and brothers dey treat deir mama wit wickedness.
Pastor kolet pesin wife
One woman call ontop our backyard say her madam dey pay her 10,000 naira and di moni no fit reach to take care of her pikin. So as she wan dey go back village, one man wey dey eat for her madam shop say make she come dey stay for eim house.
Ontop our backyard Nedu dey ask wetin dey cause wahala for marriages. Shey na from di house wey u dey come from abi na church abi na traditional?
Na Pere inspire me to release my song selense - White Money
Wetin u go tell 29 years old man,wey an marry 48 years old woman
Police woman lock her husband for cell for 2 weeks
Parents say dem go kill deir pikin ,if she no marry deir landlord🙆♀️
Baby factory na buisness now for Naija oo. Some women go dey pretend say dem get belle, but dem no get, when time reach dem go take anoda pesin pikin for hospital.
Ontop #ourbackyard one woman call @neduwazobiafm say she dey cheat on her husband spiritually and physically for 11 years.
Shey na until man pay ur bride price na eim go make am ur husband ?
Open mouth na open destiny and closed mouth na closed destiny
Ontop #ourbackyard Nedu dey tell men say no be every women wey tok dey go beat oo He dey ask why women dey always go back to men wey dey beat dem.
Wife dey beat her husband, sotey he dey sleep for eim car
© 2022 Steam Broadcasting and Communications Limited. Powered by Aiir.