One man say eim wife dey sleep wit oda men, collect moni.
We get 112 days to the Nigerian general election and many political parties don they drop wetin dia plan be to move Naija pipu from the hard place wey dem dey go beta place.
If your husband or wife dey abuse u physically, run sharp sharp from di marriage
Man give eim bestfriend wey be woman belle sake of say she don marry for 17 years nd she neva born for her husband.
Ontop #ourbackyard Broad Shaggi nd Chris Enete siddon tok about dia new movie Inside Life. Nedu also dey di movie
One mama call say when her pikin dey ekpoma she get belle for one boy, she tell her pikin make she no stay with di boy her pikin say no she no wan get belle everywhere.
One woman call ontop #ourbackyard say she don tire for her marriage sake of say na she dey provide
Ontop #ourbackyard with Nedu and Tombo, one woman call say she rent 2 shops for 300 thousand naira from her landlord, after she do extension and make di shop fine, di Landlord say eim wan increase shop rent.
U go fit marry pesin wey dey worship mami water spirit?
Ontop Ourbackyard wit Nedu one woman call say she meet her boyfriend for Facebook, e no tey when she get belle. Di boyfriend tell am make she no remove di belle, say make she keep am, but he no dey send am money.
Senior Pastor leave eim church for assistant pastor while eim go to Portharcourt for three months. Before di senior pastor come back, di assistant pastor don give eim pikin belle and run away with di church money.
Ontop #ourbackyard with Nedu and Tombo, Neighbor house wey mama dey keep her 4 year old girl, Dem come rape di girl front and back.
For #ourbackyard wit Nedu and Tombo, one woman tok say she meet her boyfriend for Instagram for 2018, say she tell di boyfriend say she no wan anybodi wey go break her heart, na so di boyfriend chop almost 1 million of her moni.
One 39 year old woman call ontop #ourbackyard wit Nedu and Tombo say di last time wey man toast am na for 2016, say since then no man don toast am talk more of marriage.
Ontop #ourbackyard wit Nedu nd Tombo woman call say her husband no dey sleep with am, say eim thing no dey stand, she come later find out say her husband like to dey torchlight man.
Whitemoney tok say even though pipu dey laugh am say e no sabi sing. When eim commot big brother, Big brands come buy di songs wey eim do for big brother house.
Girlfriend tell her boyfriend say she get belle, di boyfriend come tell her make she go abort di belle. She come try to do di abortion but e no work. Na so di boyfriend go meet di girl family. Afta she born na so di man no wan to dey take responsibility of d pikin.
Woman wey born three children with her boyfriend of 11 years tok say her boyfriend dey always beat her even wen she get belle.
Bcos of small quarrel , wife carry her 3 pikin commot for her husband house!!
As she no gree help her husband pay house rent em won drive her wit her pikin dem commot for house
Golden come tok say her papa and brothers dey treat deir mama wit wickedness.
Pastor kolet pesin wife
One woman call ontop our backyard say her madam dey pay her 10,000 naira and di moni no fit reach to take care of her pikin. So as she wan dey go back village, one man wey dey eat for her madam shop say make she come dey stay for eim house.
Ontop our backyard Nedu dey ask wetin dey cause wahala for marriages. Shey na from di house wey u dey come from abi na church abi na traditional?
© Copyright 2024 Steam Broadcasting and Communications Limited. Powered by Aiir.