Some pipo go do anything to make am for dis kontry, Even to cheat on customers. No be wickedness be dat??
One woman come ontop di show tell Ratata say her Pastor tell am say her pikin destiny no dey Nigeria, na so he kolet N2.8 million naira,say he wan help dem send deir pikin abroad.
The cost of things for we kontri go dey make pesin reason how we go survive?
Ontop #marketrunz @ratatanation dey tok about de 2 Sisters wey Die By Soldiers ‘Stray’ Bullet For Kudanda Market for kaduna state. And em also dey ask if u don hear of di market before and where e dey.. We for Wazobia Fm 95.1 dey say big PELENU to de family of de girls and we dey pray say dis kin BADNESS no go happen again to de pipo of Kudanda Market for Kaduna State.
U don hear of di market wey dem dey do once in a year (OYE MARKET) for Ebonyi state
Ratata say some pipu dey import pomo wey dem use chemical do
How dis fuel scarcity dey affect ur market?
Market Clash- Festac Market, Island Market and Adebayo Market for bariga
Pesin wey dey go market buy things wey e no need
Ratata say report reach am say, some market, if a seller sell fake product or goods to buyer, and di buyer later find out say de goods no dey work, come bring police arrest di seller, Shey e true say Trade unions for market no go allow de buyer arrest di seller wey sell fake products and dey no go do anything for de mata.
We hear say fire catch for Okobaba plank market for ebute meta on Wednesday 5th January, 2022 Ratata tok say as eim dey pass third mainland bridge on Wednesday he see de fire.
Mr Anthony borrow Mrs Balogun 520,000 since 2019, make she use am take start NGO, Sine 2019 na only 50,000 she don pay back.
Shey u don pay Owo Ile for any Market before?
Wetin be de risk to be gurantor for pesin wey borrow moni?
Why e be say Nigerians like to dey cheat pipu wey dey Abroad?
Egg don turn gold for Naija now
You agree say market suppose clean all de time?
Which market beta pass, Oshodi market or Idumota Market?
Tell us your experience anytime wey u don watch wrestling with your grandmama #chookmouth
One correct oga Mr. Mallam Farouk A. Salim wey be de director general of Standard Organisation Of Nigeria tok about food security for Naija..
© 2022 Steam Broadcasting and Communications Limited. Powered by Aiir.