One woman tell Ratata say dem kidnap her pikin from her shop.
By December 2023, U Go Dey Use Your Phone Check If Wetin U Buy Na Original- DG S.O.N
Man machine gun comot afta he give pesin 500 naira for Lagos.
Pesin no fit get HIV through shaking, hugging and sharing towel.
Woman wey get HIV put her blood inside di zobo wey she dey sell.
If u see bad/fake goods for market take am go Standard Organization of Nigeria Office - DG S.O.N
One woman call report sellers wey dey sell for middle of di road for BarigA Market.
Ontop #marketrunz Ratata tok say some customers dey use juju for sellers, dem go give dem 1000 naira notes and after di moni go turn small change
One woman tok ontop market runz say her husband friend borrow dem car make dem use for sometime to take hustle.
Ontop #marketrunz wit @ratatanation, We hear say Agberos dey kolet moni everyday from pipo wey dey hawk.
Ontop Market Runz wit Ratata, Dr Martina Agberien tok about wetin u supose get for inside FIRST AID BOX as market woman/man.
Ontop #marketrunz Ratata dey tell pipu dat no mata di comdition wey u dey, no just sit down at home dey wait expect pipo go give u moni, go work even if na to wash clothes
Ontop #marketrunz, Ratata make u mention dose markets wey don spread enta road, wey car and pipo no fit pass well.
Ontop Market Runz one woman call Ratata say she notice her money dey miss from her bank, she go bank and dem tell her say person dey use Card withdraw her money and so far #280,000 don commot from her account out 300,000.
Ontop Market Report for Market Runz with Ratata, one caller call report di dirty wey dey shele for market. She say some people dey use spit open nylon wey dem go use sell for u, she say some go dey sneeze, cough inside wetin dem dey sell or dey go put hand for nose and still use am sell market.
Ontop market history and location for #marketrunz Ratata tok say he go Ipodo market for Ikeja, and he see plenti things, pipu wey dey smoke igbo , and selling bodi pipo for afternoon.
Shey na true say when you go market go buy things, say if u dey carry am for head or okada, some pipu go come collect money from your hand?
If your Wife/Husband dey sell dat Market, e good if you no buy from dem ??
Some pipo go do anything to make am for dis kontry, Even to cheat on customers. No be wickedness be dat??
One woman come ontop di show tell Ratata say her Pastor tell am say her pikin destiny no dey Nigeria, na so he kolet N2.8 million naira,say he wan help dem send deir pikin abroad.
© Copyright 2024 Steam Broadcasting and Communications Limited. Powered by Aiir.