Police Don Arrest 12 People Wey Dem Suspect Say Get Hand For Di Death Of Arise TV Anchor.
Federal Capital Territory Police Command don arrest 12 people wey dem suspect say join hand for di robbery wey take di life of Arise TV anchor, Somtochukwu “Sommie” Maduagwu.
COOLWAZOBIAINFOKIDS Celebrate Customer Service Week With Call for Teamwork and Better Work Spirit
As companies for all over the world dey celebrate Customer Service Week, CoolWazobiaInfoArewaKids don bring out plenty better activities to hail the people wey dey make the work sweet, their staff and clients.
FG Dey Beg PENGASSAN Make Dem Stop Di Planned Nationwide Strike Over Di Wahala Wey Concern Dangote Refinery
Federal Government don beg Petroleum and Natural Gas Senior Staff Association of Nigeria (PENGASSAN) make dem suspend di nationwide strike wey dem plan because of di alleged mass sack of Nigerian workers for Dangote Refinery.
Lagos Government Say Dem Go Move Computer Village Pipo Go Katangowa
Some traders wey dey Computer Village for Ikeja don show serious doubt about Lagos State Govment new plan to shift di market go Katangowa for Agbado Oke-Odo LCDA.
Governor Fubara Don Come Back Rivers Afta Six-Month Emergency Rule
Rivers State Governor, Siminalayi Fubara, don land back for Port Harcourt, more than 24 hours afta President Bola Tinubu lift the six-month emergency rule for the state.
Firefighters Save Nine People From Six-Storey Building Wey Catch Fire for Lagos
Lagos State Fire and Rescue Service don rescue nine people from di fire wey happen for six-storey building for Afriland Tower, Broad Street, Lagos Island.
Naija Chef, Hilda Baci Makes World’s Largest Serving of Jollof Rice – GWR
Naija celebrity chef, Hilda Baci, don break another record again – this time around na with the dish wey dey cause fight steady between Nigeria and Ghana: jollof rice.
Enugu Judiciary Workers Don Go Strike Because Dem Never Pay Dem Salary Balance
Enugu State branch of Judiciary Staff Union of Nigeria (JUSUN) don start indefinite strike because dem never pay their salary balance and other entitlements.
Resident Doctors Suspend Strike After Federal Government Promise Dem
The Nigerian Association of Resident Doctors (NARD) don suspend dia five-day warning strike after Federal Government promise dem say dem go answer their demands.
Hilda Baci Try To Make History with World’s Largest Pot of Jollof Rice in Lagos
Hilda Baci, di Nigerian chef, don try to make history as she cook di biggest pot of jollof rice for Lagos. Di pot big well-well, e fit hold about 22,619 litres, and she use 200 bags of Basmati rice to prepare di jollof within nine hours.
DSS Summons Sowore Becos Of Anyhow Post About Tinubu
The Department of State Services (DSS) has summoned activist Omoyele Sowore over what it described as a “false and malicious” social media post against President Bola Ahmed Tinubu.
Wazobia FM 2025 August Meeting Dey Call For More Women Empowerment Programs
Di fifth annual August meeting of Mbada Women Association of Wazobia FM, Onitsha, happun on Sunday, and dem use am take remind women make dem always play their role for society development.
Eid-Ul-Mawlid: Federal Government Don Declare Friday as Public Holiday
Federal Government don declare Friday, September 5, public holiday to mark Eid-ul-Mawlid celebration.
Lagos to Host Africa’s First E1 Electric Powerboat Championship
Lagos don ready to enter history as di first African city wey go host di E1 Electric Powerboat Championship, with di race set to hold for Victoria Island waters from October 3 to 5, 2025.
Osun Oba Land 56 Months For US Prison Sake Of $4.2M COVID-19 Relief Fraud.
Oba Joseph Olugbenga Oloyede, di Apetu of Ipetumodu for Osun State, don land 56 months (almost four years, eight months) for US prison sake of say eim do multi-million dollar COVID-19 relief fraud. US District Court for Ohio, Judge Christopher A. Boyko, give am di sentence on Tuesday. Eim go still do three years supervised release, pay $4,408,543.38 as restitution, and dem go seize im house for Medina, Ohio, plus $96,006.89 wey dem grab from di fraud money.
1.3 Million Nigerians Don Pre-Register for CVR In One Week – INEC
Independent National Electoral Commission (INEC) don announce say over 1.37 million Nigerians don complete their online pre-registration for Continuous Voter Registration (CVR) exercise inside di first week wey dem launch am.
Kano Govment Talk Say Dem No Divert ₦6.5bn
Kano State Govment talk say dem no carry ₦6.5 billion comot from the state money.
Ogun APC Don Suspend Gbenga Daniel Plus One Other Person
The All Progressives Congress (APC) Working Committee for Ogun don confirm the suspension of Sen. Gbenga Daniel and Kunle Folarin, wey their wards accuse say dem dey do anti-party activities.
NBA Don Demand Make Dem Prosecute Security People Wey Beat NYSC Member for Anambra
The Nigerian Bar Association (NBA) don condemn how dem take beat Jennifer Elobor, one NYSC corper wey dey serve for Anambra State. Dem dey call make dem quickly prosecute the vigilante people wey do the thing.
Ooni, Alaafin Lock Horns Again Over “Okanlomo of Yorubaland” Title
The old supremacy battle between Ooni of Ife and Alaafin of Oyo don happen again, this time na who get power to give the title “Okanlomo of Yorubaland.”
NCAA Ban Flight Mode – Order Passengers to Switch Off Phones During Take-Off & Landing
Nigeria Civil Aviation Authority (NCAA) don release new order wey stop passengers from using “flight mode” during take-off and landing. From now, all phones and electronic devices must dey completely switched off.
Lagos Task Force Don Gbab 668 Okada inside One-Week Raid
Lagos State Environmental and Special Offences Unit (Task Force) don gbab 668 commercial motorcycles (okada) inside one-week operation raid wey dem do.
LAGFERRY Don Carry 2.5 Million Passengers in 5 Years – Balogun
Lagos State Ferry Services (LAGFERRY) don talk say dem don transport over 2.5 million passengers inside last five years, as part of di state plan to expand water transportation.
Air Peace Chairman Onyema Warn: “New Tax Go Kill Nigerian Airlines Within 48 Hours” – Call National Carrier Project Dead on Arrival
Chairman of Air Peace, Mr. Allen Onyema, don raise alarm say Nigeria airline industry fit collapse if Federal Government go ahead with new tax regime wey reintroduce customs duty and VAT on imported aircraft, spare parts and ticket sales.
Tinubu Mourn Emir of Zuru, Maj. Gen. Muhammadu Sani Sami
President Bola Ahmed Tinubu don express deep sorrow over di death of Emir of Zuru for Kebbi State, Major General Muhammadu Sani Sami (rtd), Gomo II. Tinubu describe di loss as “big blow to Nigeria.”
NSA Gbab Two Big Ansaru Terrorist Leaders Nab – Ribadu Call Am Major Blow Against Terror Waka
National Security Adviser, Mallam Nuhu Ribadu, don announce say dem don capture two top leaders of di Ansaru terrorist group – one Al-Qaeda-linked faction wey don dey terrorise Nigeria for over ten years.
APC WIN Wella for Bye-Election, Tinubu Hail INEC as Opposition Shout Ojoro!
The ruling party, All Progressives Congress (APC), don waka comot from Saturday bye-election with 12 seats out of 16 wey dem contest for 12 states. Other parties – APGA, PDP and NNPP – share the remaining four.
Aisha Yesufu Blast Ibom Air Over How Dem Treat Unruly Passenger
Human rights activist, Aisha Yesufu, don accuse Nigerian authorities say dem dey do selective justice for how dem handle di case of Comfort Emmanson, di Ibom Air passenger wey dem arrest, charge and remand for Kirikiri Correctional Centre afta she attack airline staff.
Amotekun Nab Five Suspects Wey Rob Keke Riders for Lagos-Abeokuta Expressway
Ogun State Security Network wey people sabi as Amotekun Corps don arrest five suspects wey rob and wound two tricycle riders along Lagos/Abeokuta Expressway.
FG Order Make Dem Comot Abeokuta Prison Bcos of Dirty, Bad Condition.
Federal Government don order Nigerian Correctional Service make dem move all inmates from Abeokuta prison within four weeks bcos di sanitary condition for di place bad well well.
EFCC Gbab Senator Aminu Tambuwal Over N189bn Cash Withdrawal Wahala
Officers of Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don arrest former Sokoto State governor, Aminu Tambuwal, on Monday over alleged N189 billion fraud.
Shooting Stars Assistant Coach Akin Olowokere Don Die After E Collapse for Training
Nigerian football family dey mourn as tori reach say Akin Olowokere, wey be assistant coach for Shooting Stars Sports Club (3SC), don die sudden.
Aviation Boss Festus Keyamo Don Vex, Ban Ibom Air Passenger We Assault Crew, Ground Staff
Minister of Aviation and Aerospace Development, Festus Keyamo, don para wella as e order heavy punishment afta one female passenger for Ibom Airline flight from Uyo go Lagos misbehave, attack flight crew and ground staff.
Lagos Don Order Make Dem Begin Check E-hailing Motor Dem Bcos Of Safety Wahala.
Lagos State Government don tell all e-hailing drivers make dem carry their motor go inspection, so dem fit improve safety, service quality and confam say everybody dey obey the law.
NDLEA Don Catch Church Owner Wey Kari Igbo
NDLEA don arrest Prophet Adefolusho Olasele, wey be founder and General Overseer of Turn of Mercy Church, wey dem dey also call Abbas Ajakaiye, say na him dey mastermind plenty illegal drug wey dem ship enta Naija.
PDP Warn Their Members Make Dem No Support Tinubu
Peoples Democratic Party (PDP) don give strong warning to their members wey dey support President Bola Tinubu for 2027 second term matter, say that kain support na “anti-party” and e go against wetin dey inside PDP constitution.
WAEC Don Withdraw 2025 WASSCE Results Because of Technical Wahala
West African Examinations Council (WAEC) don temporary comot di 2025 WASSCE results for school candidates sake of technical wahala wey dem discover, wey join body with one new system wey dem put to stop exam malpractice.
Aviation Minister Don Order Say Make Dem No Allow Kwam 1 Fly Again Because of Wetin Shele for Airport
Minister of Aviation and Aerospace Development, Festus Keyamo, don order Nigeria Civil Aviation Authority (NCAA) make dem put Fuji music legend, King Wasiu Ayinde Marshal wey people sabi as Kwam 1, for no-fly list because im break safety rule for Nnamdi Azikiwe International Airport for Abuja.
Time Don Reach to Honour United Ex-Super Falcons – Tinubu Must Do the Right Thing
For many years now, our legendary United Ex-Super Falcons wey win nine CAF Women’s Africa Cup of Nations (WAFCON) trophy don dey wait for promises wey different government talk but never fulfill.
D’Tigress Land Abuja With Afrobasket Trophy, Tinubu Dash Dem $100,000 Each
Na massive celebration burst out for Abuja as Nigeria women basketball team, D’Tigress, land for Nnamdi Azikiwe International Airport with their Afrobasket trophy after dem win the 2025 FIBA Women’s Afrobasket for Abidjan, Côte d’Ivoire.
I Go Do Only Four Years if I Become President – Peter Obi Talk Say Him Promise Still Stand Gidigba
Former Labour Party presidential candidate for the 2023 general election, Mr. Peter Obi, don repeat say if Nigerians elect am as president, he no go spend pass four years for office, as he believe say one term dey enough to deliver serious impact wey go change the country.
D’Tigress Make History as Dem Win 5th Afrobasket Title Back-to-Back
Na serious celebration dey go on as Nigeria women basketball team, D’Tigress, don win dem fifth AfroBasket title in a row, after dem beat Mali 78–64 for the final of the 2025 FIBA Women’s Afrobasket wey happen for Palais des Sports de Treichville on Sunday.
Lagos Government Don Warn Event Centres Say Make Dem Stop to Block Road
Lagos State Govment don give strong warning to event centres, clubs and social venues wey dey block public roads during party or celebration. This one come from the General Manager of the Lagos State Traffic Management Authority, LASTMA, Mr. Olalekan Bakare-Oki, wey issue the statement on Sunday after him go check some traffic-prone areas for Lagos.
Lagos Go Dey Get Light Wahala From July 28 to August 21 – TCN Say Make People Ready
People wey dey live for Lagos go begin experience on-and-off light from Monday, July 28 reach Thursday, August 21, as the Transmission Company of Nigeria (TCN) don start work on one major power line wey connect Omotosho to Ikeja West.
Canal+ Don Get Go-Ahead to Buy MultiChoice for $2 Billion
South Africa Competition Tribunal don approve the $2 billion takeover wey Canal+ wan do to buy MultiChoice, the company wey run DStv and GOtv.
Amaechi Don Vow Say Him Go Stop Tinubu for 2027 – Say ADC Go End Suffer Head
Former Minister of Transport and ex-Governor of Rivers State, Rotimi Amaechi, don blow hot say him go block President Bola Tinubu from winning second term for 2027.
SBM Report: Nigerians No Fit Cook Jollof Again As A Pot Don Reach N28K
One new report from SBM Intelligence don show say e no dey easy again for Naija people to cook simple Jollof rice. Di price don rise like breeze, and now, to cook one pot of Jollof rice for Nigeria go cost you around N27,528.
Senate Don Approve Tinubu $21 Billion Global Loan Request
Senate don approve President Bola Tinubu plan to borrow over $21 billion from outside for 2025 to 2026 budget period.
House of Reps Wan Pass Bill Wey Go Stop Public Servants To Dey Use Private School and Hospital
House of Reps don bring one bill wey go stop public and civil servants to dey use private school and hospital.
Yusuf Buhari Thank Nigerians for FEC Meeting as Nigeria Still Dey Mourn Late Presido
Yusuf Buhari, pikin of the late former President Muhammadu Buhari, don use him speech for Federal Executive Council (FEC) meeting touch many Nigerians wey still dey mourn the former leader.
We Dey Ready to Stop Fish Importation – FG Plans Local Production Boost
Federal Government don talk say dem no go dey import fish again as dem don ready to boost local production and support young people and women wey wan enter fish farming.
VP Shettima Land for Katsina With Late Presido Buhari Bodi, Tinubu Dey Ground to Receive Am
Vice President Kashim Shettima don arrive Katsina State Tuesday afternoon with the body of former President Muhammadu Buhari, wey die for London on Sunday, July 13.
Buratai Hail Buhari: “Na True Leader Wey Support Soldiers With All E Heart”
Former Chief of Army Staff, Lt. Gen. Tukur Buratai (retired), don describe late President Muhammadu Buhari as a firm, disciplined, and straightforward leader wey support the Nigerian Army fully during him time for office
“Buhari For Don Die Since If Na Naija Hospital E Go” – Femi Adesina
Former presidential spokesperson Femi Adesina don talk say former President Muhammadu Buhari for don die since if e bin dey use Nigerian hospitals instead of traveling abroad for medical care.
Tinubu Set Up Burial Committee for Late Buhari
President Bola Ahmed Tinubu don approve make dem form special government committee wey go arrange beta burial for former President Muhammadu Buhari wey die for London on Sunday, July 13, 2025. Buhari bin die at the age of 82 after e battle with long sickness.
Election or Takeover? APC Pack All Seats for Lagos, Critics Dey Para
All Progressive Congress don carry everything for the just concluded local government elections wey happen across Lagos State on Saturday. Dem win all 20 chairmanship seats and grab 375 out of 376 councillorship seats.
Kidnappers Miss Target as Dem Try Kolobi Taraba LG Chairman
Suspected kidnappers wey try kolobi the Chairman of Gassol Local Government Area for Taraba State, Abubakar Saidu, don fail after a midnight attempt to storm him house around 2am on Friday, July 11, 2025.
FG Declare Tuesday Public Holiday to Honour Late President Muhammadu Buhari
The Federal Government of Nigeria don declare Tuesday, July 15, 2025, as public holiday to honour the memory of late former President Muhammadu Buhari, wey die recently.
APC Win All Chairmanship Seats for Lagos LG Polls as Voters No Really Show Face
The All Progressives Congress (APC) don carry all 57 chairmanship seats and 375 out of 376 councillorship positions for the just concluded local government elections wey happen across Lagos State on Saturday. But even with the landslide victory, the main headline na say many voters no show face — voter turnout for the election low well well.
Alaafin Mourn Awujale – Call Am Visionary King Wey Get Big Mind for Him People
Alaafin of Oyo, Oba Abimbola Owoade, don send serious condolence to di family and people of Ijebuland after di death of Awujale of Ijebuland, Oba Sikiru Kayode Adetona, wey die on Sunday for age 91. Di respected king die just hours after di death of him longtime padi and former Nigerian President, Muhammadu Buhari, shake everywhere.
Peter Obi Drop Evidence To Show Say No Be Political Appointment Abacha Give Am
Former Anambra State governor, Peter Obi, don finally respond to public tok-tok about his past involvement with the late military head of state, General Sani Abacha, saying the matter no get anything to do with politics.
Olubadan of Ibadanland, Oba Owolabi Olakulehin, Don Kpai at 90
The ancient city of Ibadan don enter mourning as the Olubadan of Ibadanland, Oba Owolabi Olakulehin, don die at the age of 90. The respected monarch reportedly pass away for early hours of Monday, July 7, 2025, just two days after him mark him 90th birthday and less than one week before the first anniversary of him coronation. Family source wey confirm the news talk say the king die peacefully for him palace.
Rain Go Fall for Three Days – NiMet Warn Nigerians About Thunderstorms From Monday
The Nigerian Meteorological Agency (NiMet) don issue new weather forecast wey go affect Monday, July 8 to Wednesday, July 10, warning Nigerians to prepare well as rain and thunderstorm go scatter different parts of the country.
“Na President I Wan Be for 2027, No Be Atiku Running Mate”- Peter Obi
Former Anambra State Governor and Labour Party 2023 presidential candidate, Peter Obi, don finally open up say him go run for Nigeria presidency again come 2027, and say all di talk wey dey fly around say him wan be Atiku Abubakar running mate no follow at all.
Legendary Super Eagles Goalkeeper, Peter Rufai, Don Kpai at 61
Nigeria's football community has been thrown into mourning following the death of iconic Super Eagles goalkeeper, Peter Rufai, who passed away in the early hours of Thursday, July 2, 2025, after a prolonged illness. He was 61 years old.
Building Don Collapse for Adeniji Adele: Four People Wound, Rescue Still Dey Go On
One building don collapse early Thursday morning for Adeniji Adele Road, Isale Eko, Lagos Island, and at least four people don wound for the incident.
Labour Party Don Give Peter Obi Quit Notice
Labour Party don give Peter Obi 48 hours to comot from the party officially.
Liverpool player Diogo Jota Don Die for Car Accident Two Weeks After E Marry
One big wahala don happen as Liverpool footballer Diogo Jota don die for one bad car accident wey happen for northern Spain. Diogo Jota na just 28 years old, and e don marry im childhood babe, Rute Cardoso, just two weeks before the crash.
Afta Over 200 Pipo Die, Tinubu Don Plan Visit to Benue State This Wednesday
President Bola Ahmed Tinubu don talk say he go waka go Benue State on Wednesday to show him support and sympathize with di people wey suffer loss after recent attacks wey shake di state.
Yahoo Boys Dey Rub Nigeria Face for Gutter – EFCC Boss Para
Oga Ola Olukoyede wey be the Chairman of di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don raise alarm say Yahoo boys no just dey scam people again. Dem don carry di matter enter another level and e don turn big national disgrace.
Pope Leo Dey Pray For People Wey Die For Benue Killing, E Still Beg Make Peace Reign For Sudan.
Pope Leo don talk say e dey sorry and e stand gidigba with the victims and families of the about 200 people wey dem kill for the terrible massacre wey happen for Benue State.
Exclusive: Tolu Arokodare Fit Soon Japa From Genk – England Dey Call!
Tori don reach us say Naija striker Tolu Arokodare fit soon waka comot from Belgian club Genk as transfer market don dey hot.
Naija Midfield Machine! Deco Help Turkish Club Climb Up
At just 22 years old, Nigerian baller Emmanuel Toyin, wey dem dey call "Deco," don show say e no come play for Turkey. Di Lagos boy dey shine for Sapanca Kurtköyspor as di midfield general wey help dem win di Amateur 1 League and waka go next level for Sam Lig.
Presido Reopen Abuja Conference Centre, Wike Rename Am After Tinubu
President Bola Ahmed Tinubu don officially reopen the newly renovated Abuja International Conference Centre (ICC) on Tuesday, for Abuja. As part of the opening ceremony, e give strict order say all Ministries, Departments and Agencies (MDAs) must begin dey pay to use the place, make dem fit maintain am well and keep am for long.
UNICEF Dey Beg Kano Make Dem Declare Emergency For Polio Mata As Three Local Government Area Don Record New Cases.
United Nations International Children’s Fund (UNICEF) don call on Kano State government make dem declare state of emergency for polio and regular immunisation because the sickness don show face again for the state.
FG Go Close Ijora Bridge From April 27 To Do Serious Repair Work
Di Federal Government don announce say dem go close Ijora Bridge for Lagos from April 27, to do serious repair work.
House of Rep Don Dey Push Make The 37 LCDA Dem For Lagos Turn To Full LGAs
House of Reps don pass bill for second reading wey go give full local government status to the 37 Development Area Councils for Lagos State.
FG Don Declare Monday And Tuesday Public Holiday To Take Celebrate Eid-el-Fitr.
Federal Government don declare Monday and Tuesday as public holiday to mark this year Eid-el-Fitr celebration.
Nnamdi Azikiwe University Don Expels Student Wey Beat Lecturer For Viral Video
Di management of Nnamdi Azikiwe University, Awka, don expel Precious Mbakwe, di student wey dem catch for viral video dey beat one lecturer.
Afenifere Leader, Pa Ayo Adebanjo, Don Kpai at 96
Popular Yoruba leader and elder statesman, Pa Ayo Adebanjo, don pass away at di age of 96. Di respected Afenifere leader die peacefully on Friday, February 14, 2025, for him house wey dey Lekki, Lagos.
U.S. Congressman Talk Say USAID Dey Give Money To Boko Haram & Other Terror Groups
One U.S. lawmaker, Scott Perry, don accuse di United States Agency for International Development (USAID) say dem dey send money go Boko Haram, ISIS, Al-Qaeda and other terrorist groups.
FEC Approve $1.07 Billion to Boost Health Sector, And N4.8 Billion for HIV Treatment
Di Federal Executive Council (FEC) don approve $1.07 billion to better Nigeria health sector under di Human Capital Opportunities for Prosperity and Equity (HOPE) program.
Wahala for Zamfara: Fire Burn 17 Pupils for Islamic School
At least 17 pikin don lose dia life as fire burn Islamic school for Kauran Namoda, Zamfara State. Plenty other students wey wound don rush go hospital for treatment.
NYSC Don Increase Allawee to N77,000, E Go Start for February 2025
Brigadier General Yushau Ahmed, wey be Director-General of di National Youth Service Corps (NYSC), don announce say corps members go dey collect N77,000 allawee every month, starting from February 2025.
Tems Don Make History as Most Awarded Nigerian Artist for Grammy
Nigerian music star, Temilade Openiyi, wey everybody sabi as Tems, don make Nigeria proud again as she win her second Grammy Award for di 67th Grammy Awards wey happen for 2025.
NLC Don Declare Nationwide Protest For February 4 Bcos Of Di 50% Tariff Increase.
Nigeria Labour Congress (NLC) don declare nationwide protest for February 4 bcos of di 50% increase wey Nigeria Communications Commission (NCC) put for telecom services.
Building Collapse for Lagos Kill Two People, Injure Five
One two-storey building wey dem still dey build collapse on Tuesday for Inikpa Ajah, area of Lagos, kill two people and wounjour five others people.
Tuface Don Confirm Say Eim Don Separate With Eim Wife Annie Idibia
Popular Nigerian musician, Innocent Ujah Idibia, wey people sabi as Tuface, don confirm say e and e wife, Annie Macaulay Idibia, don separate and dem don start divorce process.
National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) Tok Say About 14.3 Million Nigerians Dey Abuse Drugs.
Prof. Mojisola Adeyeye, wey be Director General for di National Agency for Food and Drug Administration and Control (NAFDAC), don tok say about 14.3 million Nigerians dey abuse drugs.
NCC Don Approve Make Telecom Operators Increase Tariff By 50%
Di Nigerian Communications Commission (NCC) don approve tariff adjustment wey telecom operators request, but dem set di maximum increase to no pass 50 per cent.
Donald Trump Don Take Oath as 47th US President, Unveil Big Plans
For one historic ceremony wey dem do for di Rotunda inside di US Capitol on Monday, Donald J. Trump don officially take oath as di 47th president of di United States. Dis na im second term afta four years wey e comot from di White House.
Why We Increase Petrol Price – Dangote Refinery
Dangote Refinery don tok say di recent change wey dem do for di ex-depot price of Premium Motor Spirit (PMS), wey pipu sabi as petrol, na bcos global crude oil price don go up.
Khvicha Kvaratskhelia Go Join PSG for €70M+ Deal
Paris Saint-Germain don finally sign Khvicha Kvaratskhelia from Napoli as both clubs don seal di deal today.
National Assembly Wan Stop The Money Wey FG Dey Give JAMB
National Assembly Joint Committee on top Finance don tok say dem fit stop di money wey Federal Government dey give the Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) for 2025 budget.
Naomi Silekunola, Others Go Face Court For Matter Wey Concern Stampede Wey Shele For Ibadan.
Oyo State goment don carry matter go court sharp-sharp, weeks afta di stampede wey shele for 18 December 2024 children funfair wey dem do for Islamic High School, Bashorun, Ibadan.
Man United Don Kick Arsenal Commot for FA Cup
Altay Bayindir and Joshua Zirkzee change from suspects to saviors as dem help Manchester United knack Arsenal for Emirates to waka enter FA Cup next round. Di Red Devils, wey play with ten men, still manage win di penalty shootout.
Naija Don Give Eric Chelle The Job As Super Eagles Coach
Super Eagles don finally get new coach wey go replace Finidi George as dem dey prepare for di World Cup qualifiers.
West Ham don give Graham Potter the work of Manager
West Ham don confirm Graham Potter as dia new coach after dem sack Julen Lopetegui wey spend just six months for di job.
Lagos DSVA Don Confirm Say Dem Don Arrest One Teacher Wey Abuse One 3-year-Old Boy.
The Lagos State Domestic and Sexual Violence Agency (DSVA) has announced the arrest of a teacher caught on video physically abusing a three-year-old boy.
Police Don Confirm Say 18 Pipo Injure For Gas Explosion Wey Happen For Port Harcourt.
Di Police Command for Rivers don tok say 18 people wound for gas explosion wey shele for Oroazi community for Port Harcourt.
Wazobia FM Programs Manager, Uche Nwaneri Don Win Big Global Award for Management Consulting
Dem don carry beta recognize sama Better Sabi person on top Media mata and person wey dey show way for media issue dem Uche Nwaneri. This one shele for Lagos inside Nigeria on the 20 day of December 2024.
FCT Police Don Ban Tinted Glass for Abuja to Stop Crime
Video
The Federal Capital Territory (FCT) Police Command don talk say dem go stop people from dey use tinted glass for Abuja.
EFCC Tok Why Dem No Show di Owner of di Abuja Estate Wey Dem Seize
The Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don respond to the dragging wey people drag dem about why dem no show di owner of di big Abuja estate wey dem gba and give di Federal Government on Monday.
Lagos State Eye 24hrs Power Supply, As Governor Sanwo-Olu Sign Lagos Electricity Bill
Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu, don sign the Lagos Electricity Bill 2024 into law, one major step wey go bring steady 24-hour power supply inside the state.
UK Wan Deport Nigerian Pastor Tobi Adegboyega Over £1.87m Fraud Wahala
Pastor Tobi Adegboyega, Nigerian pastor wey eim Wikipedia page tok say eim be a cousin to actor John Boyega, don lose him fight to stay for UK as immigration tribunal don rule say make dem deport am go Nigeria.
WTO Don Reappoint Okonjo-Iweala as Director-General.
The World Trade Organization don reappoint Ngozi Okonjo-Iweala for second term as im Director-General.
Port Harcourt Refinery Don Start Full Work Again After Small Scale Down Management.
The Port Harcourt refinery don start full work again after small reduced work, Mr Ibrahim Onoja, the company MD talk.
Tinubu Don Appoint Di Pikin Of Late MKO Abiola, As SSA On Linguistics And Foreign Matters.
President Bola Ahmed Tinubu don approve say make Jami'u Abiola be di Senior Special Assistant(SSA) to di president on Linguistics and Foreign Matters.
Yahaya Bello Plead No Guilty For All Di Charges Wey Dem Carry Go Am For Di Alledged N110bn Fraud.
Former Kogi state governor, Yahaya Bello, don plead not guilty to all di 16 count charges wey EFCC bring come for am.
LASG Commot People Wey Build Rooms Under Eko Bridge, Arrest One Man
The Lagos Environmental Sanitation Corps (LAGESC), wey people sabi as KAI, don chase illegal occupants wey build 84 rooms under Eko Bridge for Elegbata, Lagos Island.
Good News for Nigerians as Petrol Landing Cost Don Drop to N976 per Litre
Nigerians fit soon see small relief for petrol price as landing cost don drop to N971 per litre, wey dey bring hope say pump price fit go down small for people wey don dey suffer high petrol price.
If di new bill pass, Nigerians Wey dey earn over N100m monthly go fit pay 25% tax - FG
Di Chairman of di Presidential Committee on Fiscal Policy and Tax Reforms, Taiwo Oyedele, yarn dis one for one break out session during di Nigeria Economic Summit wey NESG organize.
Super Eagles Don Come Back Naija
Super Eagles don come back Naija from Libya, after wetin dem been face for the North African country.
Naija Army Don Scatta 15 Area Wey Dem Dey Make Fake Fuel Inside
Di Nigerian Army 6th Division don report say dem burst 15 area wey dey do the business of to dey make fuel and oda petrol product wey government no give dem go ahead to make. Dem also arrest 10 suspects for di places wey dey for Niger Delta.
Armed Herders Don Dey Take Over 20 Community For Benue - Ojema
Remember say e never too tey wey Fulani Bandits take over Egwuma community for Agatu and dem kill 2 soldiers and six pipo.
Time Don Reach To Find New Independence - Sowore
Former Presidential Candidate, Omoyele Sowore, tok say timedon reach for Nigeria to find New Independence from internal colonizers
NYSC Allawee: Some Corps Members Dey Ask Weda Di New Allawee Change Anything.
Some NYSC Corp members dey ask Weda di new Allawee make any difference for dis time wey Nigeria Economy get as e be.
Presido Don Swear In Kekere-Ekun As 23rd CJN
President Tinubu don swear Justice Kudirat as 23rd Chief Justice of Nigeria
FG Donate 64 CNG Bus Give Labour Union and NANS
Di Federal Government don give ova 64 Compressed Natural Gas (CNG) bus to some pipo of TUC, NLC, and NANS.
President Tinubu Don Tok About Eim Plan to Change Eim Cabinet - Onanuga
Special Adviser to Presido on Information and Strategy, Bayo Onanuga tok say Presido get plan to change eim cabinet.
$49.8B No Loss For My Tenure - Jonathan
Former Presido Goodluck Jonathan Don Tok Say Di Federal Government No Lose $49.8 Billion For Im Tenure As Presido.
Federal Government Don Raise Corps Members Allawee To N77k Everi Month
Di Federal Government of Nigeria don approve increase in allawee wey National Youth Service Corps (NYSC) members dey collect from N33k to N77k.
Dem don confam Justice Kudirat Kekere-Ekun as substantive Chief Justice of Nigeria (CJN)
UNGA 79: Tinubu Dey Ask Make Dem Forgive Nigeria Gbese
President Tinubu dey beg make dem forgive Nigeria and oda developing countries from creditors and multilateral financial institutions.
NNPC Ltd Tok Say Dem No Pay Fuel Subsidy
Nigerian National Petroleum Company Limited (NNPC Ltd.), tok say dem never pay fuel subsidy give anybody since di last nine months.
Lagos Court Don Tok Say Make Protesters Use Freedom and Peace Park For Lagos
Lagos State government don secure court order wey restrict protesters to Gani Fawehinmi Freedom Park for Ojota and Peace Park for Ketu.
Onyeka Onwenu don die at 72
Naija music legend, Onyeka Onwenu, wey people sabi as 'Elegant Stallion', don die at di age of 72.
Gunman Shoot for Trump Rally For Pennsylvania, One Person Die And Three Wounjur
Wahala burst for Saturday for rally wey dem do for former President Donald Trump for Butler, Pennsylvania wen one gunman start to shoot anyhow, wey lead to one person die and three others wound.
FG Re-Open Water Labs Dem To Fight Cholera
Minister of water resources and sanitation, PROF.Joseph Utsev, Say dem don wake up laboratory for six geopolitical zones to stop cholera wey dey spread.`
Rivers Crisis: Governor Fubara Don Swear in Caretaker Chairmen For 23 Local Government
Ogu/Bolo LGA get Evans Bipi, and Okrika LGA na Princess Ogan wey dem give...
EFCC Don Carry Cubana Chief Priest Go Court Becos Of Naira Abuse
EFCC don carry Okechukwu Pascal wey many people know as Cubana Chief Priest go Federal High Court for Lagos today (Wednesday). Dem tok say eim dey violate Central Bank Act of 2007 becos eim spray and tamper with naira for party.
Sheik Gumi Tok Say Nigerian Security Forces Know Wia Bandit Dem Dey
Di Islamic cleric Sheikh Ahmed Gumi don tok say Nigerian security forces know wia di bandits wey dey cause wahala for Northern Nigeria dey.
Tinubu Don Tok Say Make Ministers and Oda Govt Official Dem No Go Obodo Oyibo Anyhow Again
Presido Bola Tinubu don ban ministers, Oga of agencies, and oda government officials say make dem no use government moni go outside kontri again.
Adaora Umeoji Don Become Zenith Bank First Female GMD/CEO.
Adaora Umeorji don become Oga kpatakpata (GMD/CEO) for Zenith Bank PLC,na she be di first woman to Sidon for di seat.
SSANU And NASU Don Tok Say Dem No Go Work Until FG Pay Dem
Di Senior Staff Association of Nigerian Universities (SSANU) and di Non-Academic Staff Union (NASU) don go on strike wey go affect all university for we kontri bcos of di salary wey Federal Government no gree pay dem
Defense HQ Don Post Di Photo & Names Of Officers Wey Die For Delta Community
Defense Headquarters don release di names and pictures of di 17 military personnel wey dem kill for attack wey happun for Delta State.
Beta Drama Shele Inside OLD TRAFFORD As MAN U Give LIVERPOOL Gbas-Gbos On Top FA QUARTERFINAL
Manchester United climb okada, vex knack Liverpool 4-3 for di FA Cup quarter-final wey burst football fans dem brain inside Old Trafford on Sunday, March 17 2024, as Amad Diallo score di winning goal for di 120th minute to pour sand inside Jurgen Klopp and eim boys dem garri as dem dey dream to win the quadruple this season.
The Olubadan Of Ibadan Don Kpai Afta Shikini Illness
The 42nd Olubadan of Ibadan Land, HRM Oba Moshood Olalekan Balogun, don go join him ancestors for yonda on Thursday, March 14, 2024 at the University College Hospita (UCH), wey dey Ibadan after tintini malaria.
Kaduna Students: Kidnappers Dey Ask For N1bn Ransom, Or Dem Go Kill School Pikin Dem In 20 Days
Di kidnappers wey kidnap di Kaduna school children don talk to di tok tok pesin of di families wey dem kidnap and dem dey demand for 1billion naira before dem go release di student dem.
Kano DISCO Dey Blame Company Wey Dey Give Light Say Dem No Dey Give Better Light.
Kano Electricity Distribution Company (KEDCO) don tok say di reason why full current for di area wey dem dey cover (Kano, Katsina, and Jigawa States) na bcos di megawatts dem dey get from Transmission Company of Nigeria don drop.
Stop To Dey Register Small Pikin For UTME- JAMB
The Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) dey warn parents make dem no register dia pikin wey still small for UTME exam.
Nigeria Don Reopen Land And Air borders With Niger.
Presido Bola Tinubu don give order say make dem open Nigeria land and air borders wey dey with Niger, afta e don close dem for seven months.
Federal Government Don Suspend Student Loan
Federal Government don postpone di launch of Nigerian Students Loan Scheme.
Senate Suspend Senator Abdul Ningi After Eim Tok Say Dem Add Money For Budget
Senate don suspend Senator Abdul Ningi for three months sake of say dem eim tok say dem dey add extra money on top budget.
Sachet Of Pure Water Fit Enta ₦100, Join Bodi Pure Water Producers Dey Warn
The Association of Table Water Producers don come out come shout say the way price of the things wey dem dey use take produce pure take dey go up. The price of the product fit enta ₦100 per sachet.
Cooking Gas Don Go Up By 38%
Cooking gas prices don reach #16,250 for 12.5KG cylinder
Former Governor Of Lagos Tok About the Economic Waka For Naija
Akinwunmi Ambode, wey be former governor of Lagos State, yarn for di 2024 Akinjide Adeosun Foundation (AAF) leadership colloquium and award wey dem call "Economic Asphyxiation - Di Wisdom of Authentic Leaders" for Lagos.
FG Tok Say Third Mainland Bridge Go Close for 24 Hours
Federal Ministry of Works talk say dem go close both sides of Third Mainland Bridge from noon on Wednesday reach noon on Thursday.
Nigeria Custom Don Start To Sell Rice Wey Dem Seize
As part of dia waka to stop food scarcity wey dey sama pipu inside Nigeria wey, di Nigeria Customs Service (NCS) under di leadership of Comptroller-General Bashir Adewale Adeniyi MFR don show face with better plan.
Video Of Protest For Kwara Na Old Video - Emir Of Kwara
Emir of Kwara State, Alhaji Ibrahim Sulu-Gambari, don yarn say di video wey dem trend say protesters enta eim palace come dey protest against presido Tinubu no be true. Eim come tok say na old video, and di protest na about the way wey thing take hard for countri.
AFCON 2023: Nigeria Go Face Cameroon For Di Round of 16
Di Super Eagles of Nigeria on Saturday go play with Cameroon for di Round of 16 for di Africa Cup of Nations (AFCON) for Cote d’Ivoire.
Court Give Man Life Sentence Becos Eim Touchlight Eim 3 Daughters
Lagos High Court don yan say Samuel Ademola Oladimeji go siddon for prison three times life for di way wey him carry do im three pikin wey him sexually abuse.
Lagos Govt Don Ban Di Use of 'Takeaway Packs', and oda Single Use Plastics
Di Lagos State Government don announce ban ontop di use and distribution of 'Takeaway Packs' and oda plastic wey pipo dey use once.
Oyo Explosion: Illegal Miners Dey Responsible, Two Pipo Don Kpai- Seyi Makinde
Governor Seyi Makinde don tok say two people don kpai for di explosion wey shele for Ibadan on Tuesday night, and 77 oda injure.
Kidnapping For Di Kontri No Follow For Di Way God Tok Say Make We Dey Behave- Tinubu
President Bola Tinubu tok say e no gree with di way kidnapping dey happen di country. E tok say dis kain tin no follow for di way God say make we dey behave.
FG Don Cut Transport Price by Half, And Free Train Ride for Christmas Waka
Federal Government don gree to cut 50% for transport fare wey Nigerians go dey use waka between December 21, 2023, and January 4, 2024, for dis yuletide season.
Ondo Gov Akeredolu Don Give Power To Eim Deputy As Eim Dey Go Medical Leave
Governor Oluwarotimi Akeredolu of Ondo State dey prepare to waka enta medical leave, and e go transfer eim power give eim deputy, Lucky Aiyedatiwa.
Port-Harcourt-Maiduguri Rail Line go Start to Work This Year
Train services go start for di Port Harcourt-Maiduguri rail line this year, na so di Civil Engineering Construction Corporation (CCECC) tok.
Opebi-Ojota Link Bridge Go Ready Third Quarter(2024)- Gov Sanwo-Olu
Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu tok say di Opebi-Mende-Ojota Link Bridge go dey ready by third quarter(2024).
Air Force Don Deny Di Accidental Killing of Civilians for Kaduna Air Strike
Airstrike reportedly kill many people for Tudun Biri village for Igabi Local Government Area for Kaduna State.
You Fit Still Dey Use Di Old Naira Notes- Supreme Court
Supreme Court don tok say make dem still dey use di old N200, N500, and N1,000 notes for Naija until dem tok anoda thing.
Presido Tinubu Enta Naija After Him Go Di G20 Summit For Germany.
Presido Bola Tinubu don come back Abuja after him go di G20 Compact with Africa (CwA) Conference for Berlin, Germany.
Court Still Hold Emefiele for Kuje Prison
Di former governor of Central Bank of Nigeria (CBN), Godwin Emefiele, court don hold am for Kuje Correctional Centre.
Doctors Don Cut One Of Mr Ibu Leg
Nollywood Actor, John Okafor, wey people sabi as Mr. Ibu, don do surgery wey dem comot one of im leg.
One Lagos Doctor Don Chop Life Imprisonment Because Eim Rape Eim Wife Niece
Dr. Olufemi Olaleye, wey be the Medical Director of the Optimal Cancer Care Foundation, don collect life imprisonment sentence because eim use by force take torchlight eim wife niece.
We Go Start To Give Student Loan From January 2024 - Presido Tinubu
President Bola Tinubu don yarn say dem go start to use the student loan plan for January 2024.
Federal Government Wan Close Third Mainland Bridge For Repair.
Federal Government tok say dem go close Third Mainland Bridge from midnight for Saturday, October 21, reach midnight for Sunday, October 22, sake of repair.
Tinubu go Head Di Second FEC Meeting Today
Presido Bola Tinubu go siddon as oga for di Federal Executive Council (FEC) meeting on Monday morning.
Ifeanyi Ubah Don Comot For YPP, Don Join APC
Di Senator wey dey represent Anambra South, Ifeanyi Ubah, don comot for di Young Progressives Party (YPP) to go join di All Progressives Congress (APC).
Tinubu Don Appoint Ola Olukoyede as Di New EFCC Chairmo
Presido Bola Tinubu don appoint Ola Olukoyede as Chairmo of di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC).
Army Major General Go Collect Room For Prison Because Of Money Wey Eim Tiff
Army major general, Umaru Mohammed, wey Nigerian Army court-martial. Go collect room self contain inside jail, as the court say eim dey do 14 out of the 18 case wey dey on top eim head.
Bolanle Raheem: Police Officer Drambi Vandi Go Die By Hanging
Lagos State High Court wey dey for Tafawa Balewa Square annex, Igbosere, for Lagos Island, don tok say suspended Assistant Superintendent of Police (ASP) wey dem call Vandi.
Tinubu Give INEC Fake Result- Atiku Lawyer
The lawyer wey dey represents di presidential candidate of di Peoples Democratic Party, Atiku Abubakar, don tok say President Bola Tinubu give the Independent National Electoral Commission (INEC) fake certificate for di 2023 presidential election.
Nnamdi Kanu: Supreme Court Don Sets December 15 As Day Of Judgement
Supreme Court don set December 15 as di date wen dem go deliver dia judgement on top di appeal wey dem wan make dem release Nnamdi Kanu, di leader of Indigenous People of Biafra (IPOB), wey dem dey hold for detention.
Lagos: Police don confam say two pipo die for di accident wey happen for Ago Palace Way.
Di Police Command for Lagos State don yan say two pipo, including one woman wey dey pregnant, die for di accident wey shele for Ago Palace Way, Okota area on Tuesday.
Mohbad: Naira Marley Dey Our Hand- Police
Police for Lagos don confam say Afrobeat musician Azeez Fashola wey pipo sabi as Naira Marley dey dia custody because e get link to di death of Ilerioluwa Aloba, wey people sabi as MohBad.
NLC and TUC don suspend the strike wey dem plan.
Naija Labour Congress (NLC) and Trade Union Congress (TUC) don suspend the strike wey dem plan to start today, 3 October, for 30 days.
Chicago State University Don Release Presido Bola Tinubu Academic Records
Chicago State University (CSU) for United States on Monday release di academic records of President Bola Tinubu to former Vice Presido Atiku Abubakar.
INEC Don Fix Dates for Governorship Elections for Edo & Ondo
Di Independent National Electoral Commission (INEC) don announce di dates for di governorship elections for Edo and Ondo States.
NLC & TUC go Start Indefinite Strike From October 3 On Top Subsidy Palava
Organized labor, di Trade Union Congress (TUC) and the Nigeria Labour Congress (NLC),wey di Trade Union Congress (TUC) and di Nigeria Labour Congress (NLC) follow dey don fix Tuesday 3rd October 2023 as di date wey dem go start indefinite nationwide strike.
October 1: Federal Government Dey Plan Low-Key Independence Celebration
Di federal government tok say Nigeria 63rd independence celebration go dey low-key to show how di mood be for di kontri.
Na Three Pipo Dem Rescue as Container Crush Car for Lagos
Lagos State officials don rescue three pipo after one 40ft container fall on top one Toyota Corolla car wey dey go Ojuelegba on Sunday night.
Senate go Probe Reports Wey Tok Say Petrol Subsidy Payment Start Again for August
Di Senate go call di authorities for di petroleum sector on top reports wey tok say petrol subsidy payments don start again.
Police Don Comot Mohbad Bodi For Autopsy
Di remains of di late singer, Ilerioluwa Olademeji Aloba, wey everibodi know as Mohbad, police don go carry eim bodi for autopsy for Lagos State.
Obi Don Also Ask Di Supreme Court To Comot Di PEPT Judgement
Di Presidential candidate of Labour Party Peter Obi don file 51 grounds of appeal for supreme court to comot di judgement of di Presidential Election Petition Tribunal (PEPT) wey declare Bola Tinubu winner of presidential election.
US Court Don Order Chicago State University Make Dem Release Tinubu Records In Two Days
One US court don order di Chicago State University to release all di records wey concern Nigeria president, Bola Tinubu, give him opposition, Abubakar Atiku.
Atiku Dey Ask Di Supreme Court to Cancel Di PEPT Judgment
Di presidential candidate of di Peoples Democratic Party (PDP), Atiku Abubakar don ask di Supreme Court to cancel di judgment of di Presidential Election Petition Tribunal (PEPT),wey dem tok say na Bola Tinubu be di winner of di 2023 presidential election.
Presido Tinubu Don Nominate Cardoso as CBN Governor.
Di special Adviser to di president on Friday tok say di nomination na for 5 years first before Nigeria go confirm am.
National Grid Don Collapse
Nigeria don dey for darkness afta di national grid bin fall for early mormor on Thursday.
Government Don List Out 28 Money Apps Wey Be Scam
Di Nigerian government don remove 28 digital money sending apps from eim list of approved fintechs.
Protest Burst For Di University of Jos Over Increase in School Fees
Students of di University of Jos enta streets on Tuesday to show how dem no happy say dem increase dia school fees and oda services wey di school dey give.
Singer, MohBad, Don Die at 27
Nigerian artiste Ilerioluwa Oladimeji Aloba,a.k.a MohBad, don die. Him be former artiste under Marlian Records don die at di age of 27 on Tuesday.
Police Don Arrest Six Pipo Ontop DPO Killing
Dem don arrest six suspects for di killing of di Divisional Police Officer (DPO) of Ahoada in Rivers State.
Electricity Don Kill One Man Wen Him Dey Try Thief Transformer Cables
One man wey we never know wo e be bin die by electricity wen e dey try thief transformer cables for early momo on Friday inside the compound of di Niger State Printing Press inside Minna.
NLC Strike: Banks Go Shut Down On Di 5th And 6th Of September
Di National Union Of Banks, Insurance and Financial Institutions Employees, NUBIFIE, tok say all di banks go shut down on Tuesday 5th and Wednesday 6th September 2023.
AIT/Raypower Pepo Dem Don Dey Fear Job Loss As Dem Comot Deir Mast for PortHarcourt
Di transmitter mast of DAAR Communication Plc. don fall comot on Monday morning afta di officials of di Rivers State Government disconnect am on sunday and di mast fall yakata for ontop di di organization transmitter house.
DSS Dey Claim Say Plot Dey to Mobilize Youths for Violent Protests
Di Department of State Services tok say plans dey by pipo wey dem no go fit call dia name to start violent protests for Nigeria.
Presidential Tribunal go Give Eim Judgement For September 6
Di Presidential Election Petition Court (PEPT) go drop eim judgement on Wednesday 6 September.
Big Brother Housemate Don Beg For Him Yama Yama Tok.
Big Brother Housemate Seyi Awolowo don beg again for eim yama yama tok afta dem evict am wit four housemates on Sunday.
Subsidy Removal: NLC Don Declare Two Days Warning Strike
Di Nigeria Labor Congress (NLC) don declare two days warning strike becos of wetin petrol subsidy removal don cause for di masses.
© Copyright 2025 Steam Broadcasting and Communications Limited. Powered by Aiir.