On Air Now

Oga Madam Office

10:00am - 2:00pm

Rivers Don Get Free Health Care For Pipu Wey Water Pursue

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Odu tok sai flood victims fit go fit dey treated for any of di hospitals wey di govt don select...

Flood victims for Rivers State no go need fear sai sickness go add another wahala to wetin dem already dey face, as di state govment don tok sai dem go give free medical care to ein residents wey flood dey affect.

Di Chairmo of di 2026 Flood Prevention and Management Committee, Professor Ngozi Odu, tok dis one on Tuesday when govment dey share palliatives go give flood victims for inside Ogba/Egbema/Ndoni and Abua/Odual Local Govment Areas

Odu tok sai flood victims fit go fit dey treated for any of di hospitals wey di govt don select, and add sai na govment go pay dia bills.

She tok sai di state govment don dey carry wetin dis pipu for flood-affected  areas dey go thru for head.

Dem join tok sai di govment dey join flood relief with free health insurance, so to sai di flood victims no go dey battle water for one side and sickness for another side.

Comments

Add a comment

Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Light rain

    High: 27°C | Low: 22°C