Di meeting between FG and Nigeria Labor Congress (NLC)on top fuel subsidies on Wednesday evening no get head.
Di Central Bank of Nigeria(CBN) don deny tok tok about di devalue of naira to di US dollar.
President and Vice President resume in Aso Rock Villa as Nigerians dey wait official appointments.
Presido Tinubu don tok say under eim administration , di time of fuel subsidy don finish.
Di Founder of DAAR Communications Plc, High Chief(Dr.)Raymond Dokpesi don die.
Dem don swear Ahmed Bola Tinubu as di sixth President of Nigeria.
Lagos State Police don Arrest 2 Yoruba Nation pipo wey dey cause wahala and Oyo State Police arrest 5.
Di Nigeria Police Force don tok say Federal High Court for Awka no sack IGP of Police.
Di Supreme Court don dismiss case wey PDP dem tok say President- elect Bola Tinubu and eim Vice President- elect Kashim Shettima no qualify.
Everybody eye don dey on top supreme court as na today dem go drop judgement on top di case wey PDP carry against APC, Bola Tinubu and Kashim Shettima and e go happen today.
President Muhammadu Buhari don carry national honours give President-elect Bola Tinubu and Kashim Shettima, the vice-president-elect.
FG don approve policy wey go let ATM card to fit be I.D card.
Before eim first tenure go end Governor Babajide Sanwo-Olu don announce di dissolve of Lagos State executive council and di sacking of all di political officeholders and aides.
Di bill to compensate #EndSARS victims don pass second reading for senate.
Police don release Afrobeat Musician, Seun Kuti on bail.
South-East Governors don agree say dem go name the Second Niger Bridge after President Muhammadu Buhari.
Presido Muhammadu Buhari don commission di 2nd Niger Bridge and six other big projects wey di Federal Ministry of Works and Housing don complete for di country.
Di Supreme Court On May 26 go judge di case of Peoples Democratic Party, PDP, wey dem put on top President- elect, Sen. Bola Tinubu and him Vice-President elect.
Di Largest Single Train Refinery For Di world Go Start Work For Lagos.
Two Ad-Hoc staff of Eko Electricity Distribution Company(EKEDC) shock kpai for wen dem dey work.
FG go dey carry Nigerian passports go dey give pipo house.
Resident Doctors for Naija don suspend dis strike for 2 weeks
50-year-old man rape eim neighbor 12 -year-old daughter and 24- year -old man rape 6-year -old
Buhari don give 65 ex- corpers immediate work for Federal Government work and scholarships.
One Chief Magistrates' Court for Sabo-Yaba, Lagos don gree say make dem keep Seun Kuti, the Afrobeat singer for four days extra.
Nigeria Police don find and carry di police officers wey beat okada man for Abule- Egba area for Lagos State.
Fedral Ministry of Works don confirm di closing of Apapa side of Marina Bridge
Nigeria Info Lagos don carry di award for best radio station of di year for di first Nigeria Broadcasting Awards wey happen on Wednesday night for Lagos.
Two staff members of di United States Embassy in di state don kpai by gunmen
Presido Muhammadu Buhari don come back to Abuja afta him join oda world ogas wen dem go di coronation of His Majesty, King Charles III as di King of di United Kingdom and Leader of di Commonwealth.
Presido Buhari dey tell governors elect say make dem do wetin dem promise wen dem dey campaign.
Di Nigerian Association of Resident Doctors(NARD),tok say dem go start five-day warning strike on Wednesday
Afrobeats musician, Seun Kuti don by himself go surrender for Lagos State Police Command for Ikeja
Nigerian chef, Hilda Effiong Bassey a.k.a Hilda Baci don break Guinness World Record for longest cooking time by an individual
Di Inspector-General of Police, IGP Usman Alkali Baba,don tell Commissioner of Police, Lagos State Command make im go arrest the Afrobeat singer, Seun Kuti, as im beat police officer wey wear uniform.
The Minister of Labour and Employment, Dr. Chris Ngige, don yarn say him and other ministers dey collect N942,000 afta dem pay dia tax and the only allawee wey dem dey collect na when dem travel go do work.
Di National Economic Council (NEC) announce on Thursday for Abuja say im don decide to delay di remove of petrol subsidy wey dem bin plan for June 2023.
Nigerians go ready to see three-day movement restriction for di whole country as the National Housing and Population Census go soon start.
Di Nigerian government don tok say im go comot im citizens from di war wey dey Sudan with 40 buses for $1.2 million.
Lagos Don Start To Remove Illegal Buildings For Banana Island
Di Commissioner of Police, Lagos State Command, CP Idowu Owohunwa, don order di sharp sharp remove of di Divisional Police Officer (DPO), Olosan Mushin, on top alleged misbeave for im station
Di National Drug Law Enforcement Agency, (NDLEA), don warn skit makers to stop to dey use dia logo and jackets in dia production.
Two of di Chibok schoolgirls don escape from di pipo wey kidnap dem.
NYSC Don Ask Female Married Corps Members To Go Back To Di State Wey Dia Husband Dey Stay
Presido-Elect Bola Ahmed Tinubu, don tok say make pipu no believe the tok-tok wey amebo pipu dey tok say eim no well.
President Muhammadu Buhari don come back Abuja after im eight-day official visit to di Kingdom of Saudi Arabia, where him bin join do di Umrah (Lesser Hajj).
To celebrate dis year Eid el-Fitr,di Federal Government don declare Friday, April 21, and Monday, April 24, 2023, as public holiday.
Di Debt Management Office (DMO) don dismiss tok tok pipol report wey tok say Nigeria neva fit dey pay di loan to China.
Di Nigeria Electricity Regulatory Commission (NERC),tok say e go soon provide four million prepaid meters to electricity consumers for di country.
The Lagos State Government go arrest one Uzuokwu Solomon bcos im do wayo call to di people wey dey answer emergency
Kenyan Police don arrest one man wey be Pastor of Good News International Church because eim tell eim followers make dem no chop food or drink water so that dem go fit meet Jesus.
Dino Melaye, wey be former senator, of Kogi West Senatorial District, don win the Peoples Democratic Party (PDP) governorship primary election for inside Kogi.
KPMG wey be company wey dey chook eye ontop how economy dey do, don come out come tok say for inside 2022 37.7 percent of pipu inside we country naim no get work.
One court for inside Kano state don draw hand for ear tell one Malam Yusuf say that Cockrel wey eim buy must die by Friday.
The Federal Government Of Nigeria don collect $800 million for World Bank hand wey dem go share for naija pipu after dem commot the fuel subsidy, so that pipu go fit cope with the hardship wey e go cause.
Claim: Chris Ngige bin advise APC make dem no celebrate di presidential election victory because of him experience for court with Peter Obi. Verdict: NA LIE. As we confirm from di spokesperson of Ngige wey talk say di minister no make dis kind statement.
The Nigerian police force for inside Ogun state don carry "Zazu Zeh" singer Portable enta High Court for inside Ifo on Monday morning.
Osun State Governor, Sen Ademola Adeleke don tok say di former Governor Adegboyega Oyetola get right to go Supreme Court if him no like wetin appellate court rule.
Peoples Democratic Party (PDP) for Igyorov ward wey dey Benue state don pursue di party national chairman, Iyorchia Ayu, because say dey tok say him go dey do things wey dey against deir party.
Nigeria na also di number one country for di whole of Africa wey dey suffer Tuberculosis pass.
Claim: Dem fit use Fasting as treatment for cancer. Verdict: MOST TIMES NA TRUE. Although dem don prove say fasting dey effective to treat cancer but no be di cure be dat.
The Independent National Electoral Commission, INEC don tok say di New Nigeria People's Party, NNPP governorship candidate, Abba Yusuf na im win di Saturday election for Kano State.
Di presidential candidate of Labour Party, Peter Obi, tok say him dey very sad to hear about di pipo wey die on Saturday when dem dey do di governorship and state house of assembly elections.
48 hours after the 18th of March 2023 governorship election. The Independent National Electoral Commission (INEC) don tok say na Governor Babajide Olusola Sanwo-olu win the chair of governor inside the state.
Rukayat Motunrayo Shittu wey be member of the All Progressives Congress (APC) join bodi for inside the 2023 gubernatorial election, wey be say she drag for the chair Owode/Onire constituency inside Asa local government for Kwara State House of Assembly.
sub-Saharan Africa is the region most affected by HIV/AIDS, and young people aged 15-24 years are particularly vulnerable to HIV infection
Senator Franca Afegbua family confirm say she die on Sunday.
Labour Party don promise say dem go gather deir supporters for di whole country match go Independent National Electoral Commission (INEC) office on Monday if dem no gree make deir lawyers go chook eyes for di things wey dem use for di February 25 presidential election.
Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu, don tell business pipo wey dey sell market say, make dem dey collect di old N500 and N1,000 as we go still dey use am for Lagos.
Dem tok dis one on Tuesday, for one tok tok report wey di police pipo Force Public Relations Officer, Olumuyiwa Adejobi, tok.
Supreme Court don tok say make dem dey use di old N500 and N1,000 note but customers no gree collect am from banks, as Central Bank of Nigeria (CBN), and Federal Government never still tok anything.
The vice-presidential candidate of the Labour Party (LP), Datti Baba-Ahmed, don ask party’s supporters to dey peaceful and patient as di party go carry out legal action on the just concluded election.
President Muhammadu Buhari don tell the winner of the 2023 presido election, Bola Ahmed Tinubu congratulobia for eim win.
The Independent National Electoral Commission, INEC don tok say na the candidate of the All Progressives Congress, APC, Bola Ahmed Tinubu as win the 2023 Presidential election.
Di Labour Party presidential candidate, Peter Obi, don win di presidential election for Cross River State.
Gunmen wey pipo dey feel say na politicians send don kill di traditional ruler of Umuezeokaoha Community for Ezza North LGA of Ebonyi State, Ezeogo Igboke Ewa.
Di Independent National Electoral Commission (INEC) tok say na di presidential candidate of di New Nigerian People’s Party (NNPP), Rabi’u Musa Kwankwaso na im win di presidential election for Kano State.
Di Independent National Electoral Commission (INEC) don tok say na Labour Party House of Representatives (HOR) persin for Amuwo-Odofin, wey be George Adegeye, na him win di Saturday election.
The Independent National Electoral Commission don drop the result of the Presido election for inside Ekiti state.
The presido candidates of all the political party dem wey dey inside wey obodo Nigeria don join hand take sign thr second peace accord, wey go make sure say dem no do or join bodi for any gbege level inside the election.
The Supreme court don push the mata of the new Naira note go March 3, 2023.
General Manager, Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA), Mr Bolaji Oreagba, tok dis one for statement for Lagos on Sunday.
Nigeria's Presido don tok say pipu fit still dey use the old 200-naira notes for the next 60 days starting from February 10th till April 10th.
As Naija dey join di world to celebrate Valentine Day, di oga of National Agency for the Control of AIDS (NACA), wey be Dr. Gambo Aliyu, dey tell Nigeria pipo especially di young ones say make dem use opportunity of di love and togetherness wey today dey represent take go know deir HIV result.
Nigerian military don tok say na lie say some military officers get meeting with one of di Presidential candidate, so dat dem go fit scatter di 2023 General Election.
Lagos State government don tok say make dem close Chrisland School wey dey Opebi Road for now, because of one 12-years-old pikin wey be student for di school wey die.
Federal government don tell universities across di country to close for three weeks so students fit join inside di elections wey dey come.
And dey dey promise Nigeria pipo say dem go settle everything in one week time.
Central Bank of Nigeria (CBN) dey promise Independent National Electoral Commission (INEC) say e go arrange di moni wey dem go need for any wahala for dis General Election wey dey waka come.
Di National President of the Academic Staff Union of Universities (ASUU), Prof Emmanuel Osodeke dey ginger Nigerians to vote for leaders wey go make education number one for Nigeria and no be dose ones wey go treat am anyhow.
One area boy kill bus conductor becos of money wey him won collect for police pipo.
The Nigerian Police Force want make pipu wey sabi prank pipu to dey careful with dia pranks becos "Pranks don dey put pipu for wahala"
Claim: The inflation rate today na around 16% but under di government of Peoples Democratic Party (PDP) na single figure e be .
Central Bank of Nigeria (CBN) don finally shift di deadline wey pipo go fit go pay deir old moni for bank with extra 10 days for commercial banks and 7 days for CBN.
Gunmen don attack di office of di Independent National Electoral Commission,(INEC) for Ojoto, for Idemili South Local Government Area for Anambra State.
House of Representative don gree make Presido Muhammadu Buhari borrow N1 trillion from Central Bank of Nigeria (CBN) so dat him go fit pay for di 2022 extra budget.
Di oga kpata kpata for central bank of Nigeria (CBN) Governor Godwin Emefiele done talk, say na bank dem go blame for new naira note wey no plenty outside, eim talk dis yesterday.
Rivers Debate Group na im tok say dem don change di date for di 2023 Rivers Governorship Debate.
Sanwo-Olu still send sorry to di family of di pipo wey die for di accident.
Nigerian Police Force don arrange pipo wey know bomb wella keep for where dem go take enter and commot for we country, so dat nobody go fit bring bomb or bomb materials enter our country.
Di price for petroleum motor spirit (PMS) don rise to N340 per litre for Dutse, Jigawa state Capital.
DE decision of de independent national electoral commission (INEC) to shift de collection of de permanent voters card (PVC) by pipo way don register may be bcus of de push wey stakeholders push dem on de commission to give niger pipo enough time to collect dia PVCs.
Central Bank of Nigeria (CBN) tok say na lie some Nigerians dey tok, say di new money no dey.
The National oga for Pipo Democratic Party, Dr.Iyorchia Ayu don make pipo know say de death of de PDP Governorship Candidate for Abia State, Prof. Eleazer Ikonne dey shocking.
Things wey you need to know about dis deadly disease wey be Dipthheria.
Labour Party Presidential Campaign Council tok say dem attack deir candidate, wey be Peter Obi after deir rally for Katsina on Monday.
The Independent National Electral Commission (INEC) for inside Abia state don draw hand for ear tell all dia workers say make dem no dey collect egunje (Bribe ) for the hand of people wey wan collect the Permanent Voter Cards (PVCs).
Ogun state Government don declare tuesday and wednesday for no work-day for workers wey dey for public service. Dis na to make them go office of the independence national electorial Commission(INEC) or other places wey them fit collect dis permanent voter's cards.
All-Progessives Congress Presidential Campaign Council dey tok say di presidential candidate of Peoples Democratic Party, Atiku Abubakar, no get di character to become di country president.
Plenty pipo wey dey work for one company wey dey for Gunduwawa for Kano State come out on Sunday come tok say dem no go gree as dia company dey plan to pay dia January salary with old naira note wey go expire dis month.
Train wey carry 148 pipo don spoil for forest wey dey for Kogi State come abandon dem.
Former leader dem under di military rule or for democracy get ogbonge role wey dem dey play for election mata inside Nigeria. Different important pipo dey take anything wey dis former leaders dem talk very serious especially di ones wey wan run for office .
Dem don confirm say one man wey dey work for one-storey building wey dem dey repair for Ikeja don die after di building fall ontop am and some pipo for Lagos State.
Central Bank Of Nigeria Don Dey Monitor banks wey dia ATMs still dey give old money and wan show dem pepe them.
International Labour Organisation (ILO) don tok say pipo wey no get work for di world go rise by 5.8 percent for 2023.
Labour Party LP president canditate, Peter Obi talk say him no go take am jeje when he wan put eyes for mata of insecurity wey dey for Country im sit down for president chair.
Abubakar Sani Bello wey be Governor of Niger State don order time wey di pipo of di Lambata Gurara Local Government Area for di state go fit dey open, close, or even go outside after one big fight wey happen wey dem kill di village head wey be Mohammed Abdulsafur.
Di Criminal Investigation Department, Lagos Command, don arrest 55-years-old Oluwole Akande becos say him dey pretend to be di Commissioner of Police, Railway Command, Yetunde Longe and duping one 80-years-old man of N250 million naira.
The Department of State Services (DSS) arrest the former Director General of the Obi-Datti Presidential Campaign Council, Doyin Okupe.
Police don carry forex trader wey be Temitope Badmus, go court becos dem say him thief N221.6m from six investor.
Edison Ehie tok say one woman wey bin dey find am difficult to born her pikin don born safely after she call Gov Wike name three times.
Labour Party presido flag man Mr Peter Obi, don tok say the chair of presido for Nigeria no be place wey you come siddon relax and dey chop, that na why we countri need person wey get aka gum.
Peoples Democratic Party don deny media reports say dia Presidential Candidate, Atiku Abubakar travel go London, for health challenges.
Police don arrest of di suspects wey attack Igueben train station for Edo State.
Department of State Services (DSS) don arrest di pipo wey plan di bomb blast for Kogi State near di Palace of Ohinoyi of Ebiraland for Okene wey happen on di 29 of December 2022.
Edwin Clark wey be Ijaw national leader and also di chairman of PANDEF don show him support for Peter Obi to become president.
Police for inside Akwa Ibom State Command don tok say dem don hold one Joseph Friday becos eim killing eim papa because eim feel say eim Papa dey use jazz for am.
E come be like say The Peoples Democratic Party, PDP, don finally tire for Rivers State Governor, Nyesom Wike mata as dem don drop statement wey dem use take para for wetin the Governor yarn about dia presido flag man.
Governor Sanwo-Olu say Lagos State Government dey make sure say teachers no japa to obodo oyinbo.
King of Obosi and di Prince of Oba dey praise Federal Government and dem dey also ginger FG to come finish di bridge.
Federal Government tok say dem go soon announce di increment of salary for civil and public servants, so that di workers dem go fit dey comfortable.
Police don arrest two pipo wey dem tok say dey use computer take do 419, wey dey pretend to be another pipo and dem dey also do cryptocurrency fraud dey use take thief money from people.
The mama of Omobolanle Raheem wey police pipo kill on Christmas day tok say di lawyer bin get belle of twins.
Federal Road Safety Corps (FRSC) don confirm say na seven pipo na im die for di accident wey happen for Calabar Carnival on Tuesday.
Di Central Criminal Court for London no gree make dem bail former Deputy President of di Senate Ike Ekweremadu for di second time wey dey dey try.
Germany don officially return 22 Benin Bronze wey dem bin collect from Nigeria.
NDELA say dem don catch over One Million pills of Tramadol and other hard drugs.
Osun State government don confirm say di disagreement wey dem get with police cause make dem commot di officers of di Department of State Services wey dey protect di Governor.
Children of late Kudirat Abiola, di wife of di winner of di 1993 presidential election, MKO Abiola, don sue Nigerian government say dem kill dia mama.
President Muhammadu Buhari tok say wit di plenty wahala wey Nigeria dey face for many areas, him ''don do him best for di seven-and-half years''.
CBN drop one policy for November wey tok say dem pipu no go fit dey withdraw money the way dem take they withdraw like before. And dem yarn say na 9 January, 2023 dem wan start dis new waka.
Gov.Babajide Sanwo-olu of Lagos State dey beg citizens wey don reach the age of voting to go collect their Permanent Voters Cards, from the different Independent National Electoral Commission (INEC) offices wey near dem.
The Federal Government of Nigeria don tok say sharperly make dem stop to dey collect COVID-19 Tests for people wey dey travel.
Video
The Medical and Dental Council of Nigeria don come out to come yarn say 439 doctors wey learn the work for abroad don fail the medical exam wey dem set for dem to know if dem really sabi the work.
Central Bank of Nigeria (CBN) don announces new policy say people and companies go fit only collect N100, 000 and N500, 000, cash from dia banks and any other financial institution per week.
House na one of the Koko thing wey person need for this life but for plenti Naija people e don dey hard dem to fit continu to keep the house wey dem and dia family inside.
Remember say for October, 2022. Lagos state goverment come out come yarn say dem no want make Okada dey do dia work for 10 LG, and 15 LCDAs inside the state.
Soja dem wey dey for Operation Delta Safe don destroy 44 backyard place wey pipo for dey cook crude oyel for inside Niger Delta for the last two weeks.
The Governor of Anambra state, Chukwuma Soludo don tok say the investment wey the former Governor of the state, Peter Obi they claim say eim make wen eim dey office no get level again.
Lagos Traffic Management Authority go begin arrest buses wey no get Lagos State black and yellow color wey dey carry passengers.
Di FCT Administration on Thurdsay don warn landlord dem inside Abuja wey dey turn dia house to hotel,motel and brothel say make dem shut down sharpaly or dem go lose ownership of dia house.
E get when Rivers State governor, Chief Nyesom Wike announce say he go soon begin do stomach infrastructure and people start to shout for Social Media.
President Muhammadu Buhari don announce say eim support dey wit Central Bank Of Nigeria ontop dia plan to redesign and replace some of di naira note dem .
Presido Muhammadu Buhari go do meeting today Monday wit di security chief dem for Abuja to carry see how security mata fit strong for inside Naija.
Di Independent National Electoral Commission aka INEC tok say na 93,522,272 pipo don register plus di 9,518,188 new pipo wey just register to vote.
One Federal High Court wey dey sitdon for inside Umuahia wey be di capital of Abia State don order FG to pay di IPOB leader N500 million for di damage wey dem cause ontop eim human right abuse.
Di pipo wey dey drive commercial bus for inside Lagos don warn say dem go enter strike becos of the plenty money wey di garrage pipo aka agbero dey collect from dia hand.
Di Lagos State Ambulance Service aka LASAMBUS tok say dem don save seven pipo dis early momo for di fire palava wey happen for WAEC headquater wey dey for Jibowu area.
The Independent National Electoral Commission aka INEC don invite international organization dem from obodo oyinbo to come follow put eye inside di 2023 General Election wey dey trek come.
Fear Dey Everywhere As Fuel Begin Scarce For Inside Lagos.
Di Department For State Service aka DSS don tok say everywhere dey calm after di US Embassy inside Nigeria yarn about di security warning ontop terrorist mata inside Abuja.
President Buhari don give former Presido Goodluck Jonathan,Governor Wike and 43 oda special Naija pipo di Nigeria Excellence Award For inside Public Service (NEAPS) mata.
Di United States don announce say dem go support di pipo wey flood affect inside Naija wit di amount of 1 Million Dollar.
Di Lagos Police Command don fire tear gas give protester dem for di EndSARS memorial wey popular celeb Folarin Falana alias Falz and Adebowale Adedayo aka Mr Macaroni bin lead for di Lekki tollgate today Thursday.
World Leaders for inside the World Health Summit wey happen on Tuesday for inside Berlin don promise to give extra 2.6 billion deollar to carry support di Global Polio Eradication initiative(GPEI) 2022-2026 Strategy to end polio.
Di Federal Government don tok say na di water wey full everywhere for di country na eim dey delay dem to open di Second Niger Bridge.
Di South East Council for Traditional Ruler dem and pipo wey dey represent di Igbo Archbishop and Bishop don join oda pipo dey call for di release of di leader of Biafra pipo,Nnamdi Kanu.
Di Police Command for Kwara don confam say ASP Ahmed Yusuf don dey safe from di hand of kidnapper inside bush wey dey betwwen Kwara and Oyo State.
Out of 36 states for Nigeria, 33 states dey face flood and over 600 pipo don die and 2.5 million pipo no get where to stay.
The Oga for ASUU wey be Professor Emmanuel Sodeke don annouce am on Friday morning say them don hold brake ontop the strike matter.
River State Governor,Nyesom wike don approve 1 Billion Naira to carry support di people wey flood affect
The Minister For Special Duties And Intergovernmental Affairs wey be Sen.George Akume don tok say na 450 out of the 5,000 nominees collect the 2022 National Honours Awards for their contribution for the country.
The Minister for Aviation,Hadi Sirika don officially hand over the approval document give Babajide Sanwo-Olu wey be the Governor for Lagos State.
President of di Academic Staff Union of Universities (ASUU), Prof. Emmanuel Osodeke, tok say dem go soon call off dia eight-month-old strike.
President Muhammadu Buhari don tok say goverment alone no fit be dey spend money to maintain University for we countri.
Naija military say dem don make sure say gbege pipo release di remaining 23 passengers from di Abuja-Kaduna train attack.
143 days to election, Lagos State wan increase workers salaries.
Presidential candidate of New Nigerian Peoples Party, Rabiu Kwankwaso, E say e ready to take Nigeria from dis level to anoda level, e go solve all di wahala wey Nigeria dey face.
Federal Government say second Niger Bridge go ready dis Christmas to dey use.
The pipu wey dey represent the different political parties for inside the presido election and dia party chairmo don come sign agreement say dem no go do anytin wey go make gbege before go reach afta the election for 2023.
Federal high court judge inside Lagos don draw hand for ear tok say make Labour Party and dia supporters no carry dem self go do any rally for Lekki toll gate on 1st of October.
Lagos state government don come out come yarn on top dia social media page say the train wey go ride on top the red line don land for Lagos.
Independent National Electoral Commission say dem wan train 1.4 million staff(Ad hoc staff) for 2023 general election.
Lagos State Government don receive train wey dem wan use run for inside Lagos Metro redline railway.
Former military men wey dey under the aegis of Retired Members of Nigerian Armed Forces (REMENAF) and Coalition of Concerned Veterans (CCV) don join bodi block the Ministry of Defence inside Abuja.
Nigeria’s power grid don collapse for di seventh for 2022.
Federal Government tell National Universities Commission (NUC) make dem order vice-chancellors to re-open schools nd allow students resume lectures.
Na really sad Sunday as seven pipu naim dem sure say don die wen one commercial bus burn around Iyana Oworo area of Lagos State.
The Academic Staff Union of Universities (ASUU) tok say dem dey wait for dia lawyers to give dem professional advice, sake of say the National Industrial Court of Nigeria’s (NICN) order wey say make dem end the strike.
National Industrial Court don order Academic Staff Union of Universities make dem go back to work.
Rivers State Governor, Nyesom Wike gang for inside Peoples Democratic Party, don come out come tok say dem no dey join hand for Atiku campaign until the chairmo of the party Dr Iyorchia Ayu commot for chairmo chair.
National Association of Nigerian Students don come out don shout say na lie oooo dem no get any plan block the Third Mainland Bridge on Wednesday.
First Lady Aisha Buhari dey congratulate her daughter-in-law, Zahra wey graduate wit first class honors from UK university.
Once beaten, twice mumu! Two years afta dem release am from Ethiopian prison, NDLEA don arrest 44 year old ex-convict sake of say he dey carry drugs for Lagos.
National Association of Nigerian Students don block Lagos International Airport sake of ASUU strike.
Pipo wey dey tiff light so dem no go pay plenti moni, Ikeja Electric say make dem stop e dey kill business.
Abeg oo doctors treat gunshot wound before u ask for police report.
Video
Tears flow as the Lagos State Taskforce and Lagos State Ministry of Justice join bodi take sell 134 moto wey pipu leave anyhow for roads and the one wey dem catch no dey follow traffic law.
Fashola say student protest wey shele for Lagos-Ibadan express dey against di law.
Court for UK don declare Manchester city footballer Benjamin Mendy not guilt of rape
Vice president Yemi Osinbajo don land for Inside Nairobi, Kenya to represent naija for the inauguration of William Ruto.
APC director of strategic communications, Dele Alake tok ontop channels television say Tinubu no be di father of Lagos say na eim clear di road for Lagos aka pathfinder.
Unknown gunmen don show again on Sunday as dem attack senator Ifeanyi Ubah of Anambra South senatorial district convoy.
People’s Democratic Party don name former President of Senate, Adolphus Wabara as di acting Chairman of Board of Trustees (BoT).
Queen Elizabeth II, wey be Queen of England don die at age 96, afta she don siddon throne for 70 years.
The Lagos state government tok say, e no go take am easy wit any Developer or Builder wey eim building fall and put pipu life for danger.
The National Association of Nigerian Students (NANS) don tell oga Presido Muhammadu Buhari say e come dey be like water go soon pass garri ontop the way this strike mata dey go. So dem want make oga Buhari chook mouth to solve the mata so that students go fit go school back.
Lagos State Police Command don arrest popular musician, Ice Prince, sake of say he beat police officer.
River state governor, Nyesom Wike don vex for Di national chairman of di people democratic party (PDP), Iyorchia Ayu because eim call dem pikin for de party.
Lagos State Government don warned okada riders nd passengers say dem go siddon jail for 3 years if dem catch dem dey drive for where dem ban.
Ondo State Governor, Rotimi Akeredolu say Government no suppose give pipeline security contract to Tompolo.
The presidential candidate of the All Progressives Congress (APC) wey be Bola Tinubu dey seek the support of former president, Goodluck Jonathan becos of the 2023 Presidential Election.
We no know where 14,000 children for Nigeria dey .
NNPC say dose wey dey tiff Naija Oyel get religion and security support
The Nigeria Association of Resident Doctors tok say six out of ten Doctors for naija naim plan to comot to go find better life.
One pastor for Kaduna, Enoch Sule wey be General Overseer of Prayer Tabernacle Ministry for Kamurum Bajju give two sisters belle, he deceive dem go mountain say eim wan do deliverance for dem.
Di Academic staff union of universities don extend di six-month strike
Di presidential candidate of People's Democratic party (PDP), Atiku Abubakar go welcome di former Governor of Kano state Ibrahim Shekarau to di party on Monday.
Human Rights lawyer Inibehe Effiong don be free man after eim spend 30 days for Uyo prison.
Di shop wey dey near naval quarters dey under construction when di building collapse
President Muhammadu Buhari on Wednesday tok say eim no go support any candidates of any political party wey no be APC.
Di road wey dey go Isolo to Ejigbo, FG tok say dem go use over 11 billion naira complete di road for 20 months.
Minister of Health, Dr Osagie Ehanire, say enough medical doctors dey for di kontri , nd Federal Government dey work make dem replace any medical doctor wey resign leave di kontri.
Two children don die while three adults injure when building collapse for Adeleye Street, Lady Lark for Bariga, Sunday Night.
49 year old Amoda Bola, give im pikin belle, kolet money from five men to sleep wit di daughter.
Sake of say diesel no dey, Passenger dem wey dey go Ibadan from Lagos just boku for Mobolaji Johnson Train Station today.
The police command inside Lagos, tok say at least two persons don die after stampede by worshippers for the Comfort Life Mission International Church, Lagos on Thursday.
Lagos State Government don increase the number of Local Government where dem ban okada. The Local Government areas wey dem add na, Kosofe LGA, Ikosi Isheri LCDA, Agboyi Ketu LCDA, Oshodi Isolo LGA, Isolo LCDA, Shomolu LGA.
No be only human being dem dey test for Covid now oooo.
Police for Zamfara tok say even family members die afta dem eat dia local food Dambu wey dem make from corn and vegetable.
Electricity workers don suspend strike for two weeks
Lagos State Commissioner of Police, Abiodun Alabi say make we see police as our family members no be only friend.
Presido Buhari don launch Nigeria End Malaria Council. He appoint Aliko Dangote as di chairman of di 16-member council . Presido Buhari tok say if dem do dia job well e go save Nigeria plenti moni.
Video
Shop owners dey count dia losses to fire wey start for one shopping mall inside Victoria Island, Lagos.
Join bodi of transport workers for Lagos State dey clap hand for Lagos state Government as dem ban Okada.
E be like say dis ASUU strike go still long wella, Di presido of di join bodi of lecturers for University, Professor Emmanuel Osodeke say if Federal Government do wetin ASUU want di strike fit end sharp sharp and if dem no do anything nothing go happen.
The National Union of Electricity Employees (NUEE) don start indefinite strike from today wey be Wednesday, August 17.
Police Command for Nasarawa State don confirm say dem don kidnap Nasarawa State Commissioner for Information, Culture, and Tourism, Yakubu Lawal.
One 55 year old man die for one hotel for Ikotun afta e meet eim 32 years old online girlfriend.
The Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) in seven days, don confirm 13 additional new cases of Lassa fever from five states, wey be; Ondo, Edo, Kogi, Ebonyi and Imo.
Rivers State governor, Nyesom Wike don talk one thing two times last month wey make am be like say he know something wey other people no know.
Nigeria Police Force dey advise all politicians make dem no do anything wey go cause violence and warn dia supporters make dem no dey threaten dey opposite party wey dey run for 2023 general elections.
National Drug Law Enforcement Agency say dem see about 442 Crystal Methamphetamine Drug inside smoked fish head for Murtala Muhammed International Airport, Ikeja Lagos.
Governor Nyesom Wike of Rivers State don sue the presidential candidate of the Peoples Democratic Party, Atiku Abubakar; the Sokoto State Governor, Aminu Tambuwal; even the PDP over the PDP’s presidential primary.
August 12, 2022, na very important date for global calendar. Na day wey global community put to celebrate this year International Youth Day. The reason why United Nation dey celebrate International Youth Day na to raise voices against bad bad things wey dey shele for di world with di youth. Na UN form dis International Youth Day for 1999 for di UN General Assembly.
Lagos Ministry of Transportation ban di work of di joinbodi (M.O.T Taskforce) wey dey arrest pipo wey commit offence for road. Special Adviser to Governor Sanwo-Olu ontop Transportation mata , Mr. Sola Giwa tok say dem gree to do wetin dem wan do, afta dem chook eye for inside di task force waka.
Lagos state Governor, Babajide Sanwo-Olu tok say the wahala of flooding for Lagos Island go soon be wetin we no go fit dey remember again. As dem go soon solve the mata finally wen with the construction of big gutter for Ilubirin area of the state.
The Chief Defence staff, General Lucky Irabor tok say dem don arrest the people wey dey behind the Owo Catholic Church attack. General Irabor tok the names of the people wey dey behind the attack as Idris Omeiza and Jimoh Ibrahim.
One Ikeja Special Offense Court knack death sentence for one clergyman head, Erinmole Adetokunbo and anoda pesin Adedoyin Oyekanmi, wey kee one 7-years old boy, bury im head for altar for 2017. Finally, dis one be justice for d family of d boy.
If u dey plan to travel to Ibadan by rail, u no go easily see ticket buy, dis na bcos Nigeria Railway Corporation don reduce di number of trips for Lagos-Ibadan by almost 40 percent.
Your Chook Mouth station Wazobia FM and sister tok station, Nigeria Info don secure exclusive rights to broadcast live commentaries of Premier League for di whole Nigeria.
The Cinema Exhibitors Association of Nigeria (CEAN) tok say dem make N471 million from ticket sales inside July. Dis amount mean say dem make extra N108 million increase inside box office sales from June. CEAN’s National Chairman, Ope Ajayi disclosed yarn dis one inside Lagos on Tuesday.
Delta State Governor, Ifeanyi Okowa say di issue of contract to secure oyel facility, say make dem give am to local community.
E don tay wey we dey hear say Senator Magnus Abe go soon comot from the ruling All Progressives Congress, APC, and e finally happen around two weeks ago.
Former Vice President & Presidential candidate of the Peoples Democratic Party [PDP] wey be Atiku Abubakar don carry post give Senator Dino Melaye and Dr Daniel Bwala as spokes pesi for him 2023 Presidential Campaign.
Kogi state Governor, Yahaya Bello don tok say eim no wan see pipu dey wear facemask for the state again so that dem go fit know who be who wey dey inside the state.
On tuesday one tori pesin David Hundeyin, post document wey show say we federal government sign N1.4 billion to take buy moto for the government of Niger Republic.
The former chairmo, of All Progressive Congress (APC). Adams Oshiomhole, don come out come tok say eim no know wey pipu dey jinja for Labour Party presidential candidate, Peter Obi.
Kano state Government don announce say Governor Abdullahi Ganduje don ready to sign death sentence wey dem sama Abdulmalik Tanko for oga patapata court.
Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu, don declare Tuesday, Wednesday, Thursday and Friday work free days for all Public Workers for Lagos make dem go collect and register dia permanent voters card before 30th July wey be di deadline.
Naija athlete Tobi Amusan don win cheque of $100,000 as she break di World record for di women’s 100m hurdles event for Eugene, Oregon.
“Those wey dey take moni from banks take buy dollars, na illegal to do so. If security agencies hold u, U go know say na serious offence ” Godwin Emefiele, CBN governor, tok dis one on Tuesday for di Monetary Policy Committee (MPC) meeting in Lagos.
The Nigerian National Petroleum Company Limited don agree to the new pump price for petrol. The price of fuel don increase from N165 per liter to N169 and N184 according to different state for inside Nigeria where dem dey sell fuel.
E neva reach 24hrs wey some unknown gun men carry different type of gun enta inside kuje prison, dem start to dey shoot and dey bomb different things for the prison, dem even release some of the boko haram pipu wey dey inside the prison.
The Metropolitan police for UK don come out tok say dem hold two pipu for dia station wey go enta Uxbridge Magistrates' Court today.
Video
Nigerian artist, hypeman, and content creator Oluwafemi Oladapo Oko-Eko, wey many people know as Slimcase advise parents say if dem no want make dia pikin wey wan do music smoke, make the pikin just go do gospel music.
Some teachers inside Anambra State go do protested for Anambra State House of Assembly, as dem say make Members of the house chook mouth ontop the sack letter wey goverment give dem.
Former presido don come tell all the people way win the ticket to take drag presido chair for inside the different polical party congratulobia.
The chairmo/Cheif Executive Of National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA), wey be Brig-Gen. Mohamad Buba Marwa(Rtd), don dey yarn say dem for NDLEA wan do drug test for National Youth Service Corp(NYSC) members.
One Area court for jos don arrange self contain inside prison for one barber wey eim name na Moses Tobi because eim go thief canopy.
Federal Ministry of Health don dey draw hand for ear as dem talk say you see the way our population dey grow eh, e go disturb our plan for economic growth.
Video
Abdulala wey be former Black Tribe singer, wey we know for eim song 6:30 with Davido and Peruzzi ontop eim last 7 track Ep wey di title na Unfinished Business. E don come with another fresh Single titled BESIDE YOU
The Independent National Electoral Commission chest don dey beat up and down because dem dey fear for the 2023 elections, as dem dey look say dem still get 20 million Permanent Voters Cards wey pipu neva come collect.
One Lagos State High Court don order say make dem kia kia release one inmate, Mr Maxwell Dele, wey don dey prison for over 11 years without trial. Police arrest Dele after dem call am to ask am question about eim neighbor for shop, Mr James Idem wey dem suspect say join bodi for inside thief-thief mata.
CAF champions league wey be one of the biggest club competition inside we obodo Africa don get new champions. Wydad Casablanca kpopo Al Ahly 2-0 wey come make dem CAF Champions League winners
Bola Ahmed Tinubu tok say e no go retire until e become Naija president.
Video
The mata of how long man suppose last when eim and woman the do touchlighting mata, e don be arguement wey don dey ground since 19 okokoro. And up till date we still neva gree say na so so amount of time dey okay for touchlighting.
Dem don close Shehu Shagari College of Education because of kill wey dem kill one female student for the school today
The Confederation for African Football, CAF don talk say the Godswill Akpabio International Stadium for Uyo, Nigeria go host the 2021/22 TotalEnergies Confederation Cup final on Friday, 20 May 2022.
The Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria (IPMAN) don dey knack agogo dey shout say with the way mata dey go like this e be like say petrol fit scarce. Because dem neva give dem dia N500 billion.
The dead bodi of one young lady wey dem bring out of the collapse three story building for Ebute Meta, don carry the amount of pipu wey die dia reach ten.
National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA), arrest Chief Afam Ukatu, billionaire drug baron wey dey behind di N3b tramadol deal wey linked to di Deputy Commissioner of Police wey dem suspend , Abba Kyari.
The Lagos State governor, Babajide Sanwo-Olu, don nack hand for chest tok say blue and red line rail projects go soon start work.
Pipu wey dey live for Ajegunle area of Ikorodu for inside Lagos state dey cry make the government come help dem put beta road, gutter for their area just like e be for other area inside the state.
The number of pipu wey dey contest for presido chair for inside the All Progressives Congress (APC) don dey swell up like garri wey dem soak forget, As oga Dr. Chris Ngige don where eim cap to join the waka
The terrorist wey attack and kidnap pipu for inside train wey dey go from Abuja to Kaduna don release video wey show the pipu wey dem kidnap inside forest.
The national leader of the All Progressives Congress, Bola Tinubu don tok say Vice presido Yemi Osinbajo no be eim political son.
We hear from LASTMA say dem don close CMS bridge and Eko bridge wey dey link Apongbon bcos of traffic.
21 year old Chidinma Ojukwu wey dem tok say kill super tv CEO, Micheal Ataga don win Miss Cell 2022 for Kirikiri correctional facility, as dem mark 2022 international Women’s day.
22 year old girl, Oluwabamise Ayanwole, wey go missing afta she enta brt, dem find am dead.
Special Adviser to Presido Buhari ontop media and publicity, Femi Adeshina , dey tell Nigerians make dem get patience ontop dis fuel scarcity , say we don go through worse suffering b4 and we go survive dis one.
Federal Ministry of Finance headquarters wey dey Abuja, catch fire.
Bola Tinubu, say eim ready to dirty eim self, as pipu dey plan, stop eim dream to bcom Presido for 2023.
Nigerian filmmaker Yinka Edward follow inside de crew wey make Belfast wey get 7 Oscar Nominations.
Minister of Transportation, Rotimi Amarachi, say di reason why dem neva do some projects, na bcos China no wan borrow Naija money again.
Former governor of Anambra State, Peter Obi, say e go drag Presido chair for 2023, if Peoples Democratic Party zone am go South.
National Agency for food and drug administration and control (NAFDAC) don stop registration of sachet alcohol and small small bottles of alcohol below 200ml.
Former Governor of Lagos state, Bola Ahmed say he don tell Presido Buhari say he wan contest for 2023 Presidential Election but he neva tell Nigerians.
Presido Buhari for eim interview with channels tv tok say make Nigerians go back to dey farm, He say eim dey aware say, some Nigerians no fit put food for deir tables, dat na why he dey tell us make we go back farm.
Khadijah Okunnu-Lamidi wey be de daughter of former Federal Commissioner of Works & Housing Lateef Femi Okunnu(SAN) tok say she won be de next Presido for Naija after Buhari.
Today na our Presido bday 💃 Happy 79th bday, President Muhamadu Buhari.
News wey dey reach us tok say, at least between 13 and 17 school pikin of Omole grammar school don die inside Lagos, after one truck wey carry tissue paper fail brake go kill the school pikin dem, na wetin eye witness tok.
Canada government don add Nigeria to de list of countries wey dem tok say make dem no enta deir kontri sake of de Omicron corona virus. De oda wey dem no allow inside deir kontri na South Africa, Namibia, Lesotho, Botswana, Eswantini, Zimbabwe, Mozambique, Malawi, and Egypt.
Burna boy , Wizkid, Tems and Femikuti & Madekuti don get grammys nomination for the 64th GRAMMY Awards.
Veteran Nollywood comic actor, Babatunde Omidina aka Baba Suwe don die.
Davido don receive 200 million in less than 2 days, sake of his bday
Gas explode dis morning for Ojekunle street for Ladipo area of Mushin.
Former Central Bank of Nigeria, Professor Charles Soludo don win Anambra Governor Election. He win 19 inside 21 local Goment for Anambra.
Senate Committee on Local and Foreign Loans, tok say dem no go gree make Federal Ministry of Health borrow 200 million dollars wey be 82 billion naira, take buy mosquito nets for malaria programs for 2022 budget.
Sheikh tok say declaring bandits as terrosit go come with price.
Former Governor of Ekiti state, Fayose take okada sake of Lagos traffic. He tok say Lagos traffic no dey fear face,na why he take okada, so he no go miss eim flight.
Governor of Lagos State, Governor Babajide Sanwo-olu don finally meet with de artist wey draw eim face for social media. Broda Taiye Oniyakuya, na de artist wey dey draw celebrities face jaga jaga for Instagram.
Today na de day wey we celebrate all our girl children all over de world. Dis year theme na “digital generation our generation.
Bola Tinubu tok on Sunday for the welcome back event wey happen for Government house for Ikeja, say na only God dey give and na only God dey take life. Plenti important important people bin dey for dia like Governor Sanwo-Olu , Femi Gbajabiamila(house of reps speaker)
President Buhari tok for meeting with President Salva Kiir of South Sudan on Tuesday, October 5 for Addis Ababa say, Nigeria ready to help South Sudan beta deir economy.
White money don win 90 million for Big Brother Naija Season 6 ‘Shine Ya Eyes’
As plenti badness dey shele for Northern states like Zamfara, Katsina, Kaduna ,Borno and oda states. Senate, ask President Muhammadu Buhari make eim call them as terrorists for de country.
Nysc dey advice corp members wey dey pass Abuja to lokoja, Okene or Aba , Port harcourt roads make dem call all their family members and friends, so dat dem go dey prepare ransome moni, should in case kidnappers kolobi dem for roadwey.
Presido Buhari go visit Bola Tinubu wey be National leader of All Progressive Congress (APC) , where he dey relax and dey do eim second surgery inside one month for London.
Ohanaeze Youth council dey tell federal government mak dem stop big brother naija.
Ghanaians fit enta UAE without Visa.
Emir of Kazaure for Jigawa, Alhaji Najib Hussaini - Adamu don donate 5 motorcycle and 25 torchlight give Nigeria Securiry and Civil Defence (NSCDC), Area C, Kazaure command.
Police and FRSC don come out tell Nigerians make dem stop to dey give dem bribes.
Presido don go London for check up
I no tok say mak Obi Cubana borrow Nigeria Moni - Lai Mohammed
Oyedepo tok say dem no get patience for failure, dat na why dem sack some pastors
Video
Oyedepo tok say e no gte patience for failure dat na why e sack some pastors
Video
Protest dey for Ibadan make dem release Igboho
Video
Abdul Salami dey beg Bandits make dem no do yaga yaga for salah
Video
Presido Buhari dey complain about things wey cost for Nigeria
Video
To tell your woman about all the Money wey you dey earn abi not to tell am? which one e go be?
Video
Nigeria need global support to stop security wahala
Video
Senate don increase pass mark for Nigeria loans to 61 trillion naira
Video
Wetin men and women want for relationship?
Video
Time don reach make we know which market beta pass.... Mile 12 market vs Ikotun market!
Video
Sound Sultan no dey drink alcohol, him no dey smoke ciga but e still get Cancer
Video
Anybodi wey tiff ballot box go spend 20 years for prison.
Video
National Intelligence Agency don get 4.87bn to fit track calls and messages.
Video
Married men go dey Wear Uniform to reduce cheating!!
Video
DR Fred Ostar DON TOK AM OOO...E say if u dey always tok say u get TYPHOID.... u no get TYPHOID
Video
Bandits kidnap Emir of Kadunna and oda tori
Video
how kola go take share this money wey eim win now.
Video
make una come help emma oooo, eim babe wey him wan propose to don run leave am
Video
Ogun State tok say 3 years for prsion , for anybodi wey dey do open grazing.
Video
Chief of army staff tok say he don send plenti bandits to baba God.
Video
World bank don commot Nigeria from 4 billion naira covid-19 cash
Video
Guilty or not Guilty wit Judge Chiboi ontop KuleleZone
Video
Warris dey live ontop Spotlight wit Cheche
Video
Health Na Wealth
Video
Ajo And Esusu No Be De Same Tin
Video
Market Clash Owoseni Market vs Oniru Market
Video
Husbands wey dey tell deir wife make dem no work
Video
Peace call dey tell Nedu and Ratata say she do blood oath wit her before before boyfriend, and she no fit find Charles again, as she want make dem fit cancel am.
Video
Women dey strict, we no wicked" Caller Mummy Shan.
Video
One woman call say her husband dey torchlight man and she no know wetin she fit do.
Video
Boyfriend use juju, make girlfriend no sleep with anoda man
Video
The fear of Papa dem na the beginning of Wisdom
Video
Sharp Sharp Trademark your Idea, before person claim am!!
Video
If woman dey for any relationship wey get abuse inside, make she pack her bag commot!!!
Video
Mata wey concern Cheating, dem no dey tok an finish oh!
Video
Man and woman from de same state no fit marry even after she get belle for am!!!!
© Copyright 2023 Steam Broadcasting and Communications Limited. Powered by Aiir.