On Air Now

Koolele Zone

2:00pm - 6:00pm

Soldiers Rescue Kidnapped Woman, Recover ₦8m Ransom For Plateau Operation

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Troops of Operation ENDURING PEACE don rescue one woman wey kidnappers carry go, and dem still recover ₦8 million ransom for coordinated operation for Qua’an Pan Local Government Area, Plateau State.

Military authorities talk say dem carry out di operation on Saturday, April 25, 2026, under Sector 9 Shendam, after dem use intelligence track di suspects.

Dem talk say di woman dem kidnap am on April 19 for Bauna area of Shendam LGA. Based on information wey dem gather from one suspect wey dem don arrest, soldiers trace her reach Padam Forest for Qua’an Pan LGA, where dem rescue her safe and unharmed.

Dem also recover the ₦8 million wey family of di victim don already pay as ransom, and dem don return di money.

Captain Chinonso Polycarp Oteh, wey be Media Information Officer for Joint Task Force, Operation ENDURING PEACE, talk say di success show say dem still dey work hard to break criminal gangs for di area.

Eim say di operation show their commitment to protect people and destroy kidnapping groups.

Eim add say dem take di rescued woman go General Hospital for Shendam for medical check-up before dem reunite her with her family.

Soldiers still dey continue follow-up operation to catch other members of di kidnapping gang for Shendam and Qua’an Pan areas.

Di task force still beg residents make dem dey give timely information to help security work.


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thunder storm

    High: 30°C | Low: 22°C