On Air Now

Koolele Zone

2:00pm - 6:00pm

Ikwerre Chairmo Promise Say E Go Back Entertainment, Young Talents

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

The chairman tok sai im govment sabi sai entertainment dey give young better way to hustle and e dey help bring money enter the area.

For inside di Ikwerre Local Govment Area, oga Chairmo Charles Wobodo don tok sai im go support entertainment and make better opportunate dey for young talents for the area.

Wobodo tok this one when leaders of Disc Jockeys Association of Nigeria come pay am visit for im office for Isiokpo.

The chairman tok sai im govment sabi sai entertainment dey give young better way to hustle and e dey help bring money enter the area.

E promise say im govment go support any better plan wey go make entertainers do dem work well and make the entertainment business grow for Ikwerre.

Minawhile State Chairmo of DJAN, Dikibujiri Harry, wey dem dey call DJ Blast, don congratulate Wobodo for wetin e describe as im first year for office wey full ground.

DJ Blast sai Wobodo na one of the chairmen wey dey do well for Rivers State, especially as e concern development work for im local government.

E come beg the chairman make e still put hand for the matter and support DJAN for their coming national entertainment programme.

Comments

Add a comment

Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thunder storm

    High: 26°C | Low: 22°C