Supreme Court don tok say make dem still dey use di old N200, N500, and N1,000 notes for Naija until dem tok anoda thing.
Presido Bola Tinubu don come back Abuja after him go di G20 Compact with Africa (CwA) Conference for Berlin, Germany.
Di former governor of Central Bank of Nigeria (CBN), Godwin Emefiele, court don hold am for Kuje Correctional Centre.
Nollywood Actor, John Okafor, wey people sabi as Mr. Ibu, don do surgery wey dem comot one of im leg.
Dr. Olufemi Olaleye, wey be the Medical Director of the Optimal Cancer Care Foundation, don collect life imprisonment sentence because eim use by force take torchlight eim wife niece.
President Bola Tinubu don yarn say dem go start to use the student loan plan for January 2024.
Federal Government tok say dem go close Third Mainland Bridge from midnight for Saturday, October 21, reach midnight for Sunday, October 22, sake of repair.
Presido Bola Tinubu go siddon as oga for di Federal Executive Council (FEC) meeting on Monday morning.
Di Senator wey dey represent Anambra South, Ifeanyi Ubah, don comot for di Young Progressives Party (YPP) to go join di All Progressives Congress (APC).
Presido Bola Tinubu don appoint Ola Olukoyede as Chairmo of di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC).
Army major general, Umaru Mohammed, wey Nigerian Army court-martial. Go collect room self contain inside jail, as the court say eim dey do 14 out of the 18 case wey dey on top eim head.
Lagos State High Court wey dey for Tafawa Balewa Square annex, Igbosere, for Lagos Island, don tok say suspended Assistant Superintendent of Police (ASP) wey dem call Vandi.
The lawyer wey dey represents di presidential candidate of di Peoples Democratic Party, Atiku Abubakar, don tok say President Bola Tinubu give the Independent National Electoral Commission (INEC) fake certificate for di 2023 presidential election.
Supreme Court don set December 15 as di date wen dem go deliver dia judgement on top di appeal wey dem wan make dem release Nnamdi Kanu, di leader of Indigenous People of Biafra (IPOB), wey dem dey hold for detention.
Di Police Command for Lagos State don yan say two pipo, including one woman wey dey pregnant, die for di accident wey shele for Ago Palace Way, Okota area on Tuesday.
Police for Lagos don confam say Afrobeat musician Azeez Fashola wey pipo sabi as Naira Marley dey dia custody because e get link to di death of Ilerioluwa Aloba, wey people sabi as MohBad.
Naija Labour Congress (NLC) and Trade Union Congress (TUC) don suspend the strike wey dem plan to start today, 3 October, for 30 days.
Chicago State University (CSU) for United States on Monday release di academic records of President Bola Tinubu to former Vice Presido Atiku Abubakar.
Di Independent National Electoral Commission (INEC) don announce di dates for di governorship elections for Edo and Ondo States.
Organized labor, di Trade Union Congress (TUC) and the Nigeria Labour Congress (NLC),wey di Trade Union Congress (TUC) and di Nigeria Labour Congress (NLC) follow dey don fix Tuesday 3rd October 2023 as di date wey dem go start indefinite nationwide strike.
Di federal government tok say Nigeria 63rd independence celebration go dey low-key to show how di mood be for di kontri.
Lagos State officials don rescue three pipo after one 40ft container fall on top one Toyota Corolla car wey dey go Ojuelegba on Sunday night.
Di Senate go call di authorities for di petroleum sector on top reports wey tok say petrol subsidy payments don start again.
Di remains of di late singer, Ilerioluwa Olademeji Aloba, wey everibodi know as Mohbad, police don go carry eim bodi for autopsy for Lagos State.
Di Presidential candidate of Labour Party Peter Obi don file 51 grounds of appeal for supreme court to comot di judgement of di Presidential Election Petition Tribunal (PEPT) wey declare Bola Tinubu winner of presidential election.
One US court don order di Chicago State University to release all di records wey concern Nigeria president, Bola Tinubu, give him opposition, Abubakar Atiku.
Di presidential candidate of di Peoples Democratic Party (PDP), Atiku Abubakar don ask di Supreme Court to cancel di judgment of di Presidential Election Petition Tribunal (PEPT),wey dem tok say na Bola Tinubu be di winner of di 2023 presidential election.
Di special Adviser to di president on Friday tok say di nomination na for 5 years first before Nigeria go confirm am.
Nigeria don dey for darkness afta di national grid bin fall for early mormor on Thursday.
Di Nigerian government don remove 28 digital money sending apps from eim list of approved fintechs.
Students of di University of Jos enta streets on Tuesday to show how dem no happy say dem increase dia school fees and oda services wey di school dey give.
Nigerian artiste Ilerioluwa Oladimeji Aloba,a.k.a MohBad, don die. Him be former artiste under Marlian Records don die at di age of 27 on Tuesday.
Dem don arrest six suspects for di killing of di Divisional Police Officer (DPO) of Ahoada in Rivers State.
One man wey we never know wo e be bin die by electricity wen e dey try thief transformer cables for early momo on Friday inside the compound of di Niger State Printing Press inside Minna.
Di National Union Of Banks, Insurance and Financial Institutions Employees, NUBIFIE, tok say all di banks go shut down on Tuesday 5th and Wednesday 6th September 2023.
Di transmitter mast of DAAR Communication Plc. don fall comot on Monday morning afta di officials of di Rivers State Government disconnect am on sunday and di mast fall yakata for ontop di di organization transmitter house.
Di Department of State Services tok say plans dey by pipo wey dem no go fit call dia name to start violent protests for Nigeria.
Di Presidential Election Petition Court (PEPT) go drop eim judgement on Wednesday 6 September.
Big Brother Housemate Seyi Awolowo don beg again for eim yama yama tok afta dem evict am wit four housemates on Sunday.
Di Nigeria Labor Congress (NLC) don declare two days warning strike becos of wetin petrol subsidy removal don cause for di masses.
Elon Musk, Di Man wey get X (Twitter before before), announce on Thursday say di social media platform go soon get new feature for video and audio calls.
Di UK police don begin search for di British-Nigerian poet Gboyega Odubanjo who dissappear for remote music event.
Military for Gabon don announce say President Ali Bongo dey house arrest.
Na event wey beta well well wey celebrate di important role wey women dey play for di development of our societty as Wazobia 93.7 FM, Onitsha held its 2023 Mbada Women August Meeting on Sunday.
Former Vice Presido, Atiku Abubakar tok ontop X(Twitter before) say make Presido Bola Tinubu explain di primary and secondary school him go.
Di Human Rights Writers Association of Nigeria (HURIWA) don accuse di Minister of Art, Culture, and Creative Economy, Hannatu Musa Musawa, on top say she dey serve as minister as she dey do di compulsory one-year National Youth Service Corps (NYSC) scheme.
Di Lagos State House of Assembly on Wednesday decline di confirmation of 17 nominees wey Governor Babajide Sanwo-Olu recommend for commissioners and special advisers.
Di Federal Government don approve di sum of N5bn for each state to take buy food stuffs and items to share for di poor for dia states.
Presido Bola Tinubu on Monday go swear in di new ministers with dia assigned portfolios.
Presido Bola Tinubu don finally give portfolios to him 46 ministers.
Nigeria Labour Congress (NLC) don dey threaten again to go indefinite nationwide shutdown of di country, if another increase dey Petrol Pump price from di 617 naira wey e dey
Di federal government don announce eim plan to knack 20 fresh charges on top Godwin Emefiele, di governor of the Central Bank of Nigeria (CBN) wey dem suspend.
Di latest report wey di National Bureau of Statistics (NBS) release don show say inflation rate for Nigeria jump enta 24.08% for July.
President Bola Tinubu don direct di Central Bank of Nigeria (CBN) say make dem apply strict monetary policies wey go fit balance naira and add ginger to di nation's economy.
Oil sellers for obodo naija don warn say di fuel price fit add money anytime soon, and e go dey between N680 and N720 per liter.
Di Federation of International Football Association (FIFA) don knack England dia Round of 16 clash with Nigeria for Brisbane on Monday. Di Federation of International Football Association (FIFA) don knack England dia Round of 16 clash with Nigeria for Brisbane on Monday.
Di Socio-Economic Rights and Accountability Project (SERAP) tok say e go sue Senate President Godswill Akpabio on top say him dey give “holiday allowances” to senators by di Clerk of the National Assembly.
Two people die for inside accident wey involve six private cars for Eko Bridge on Wednesday.
Presido Bola Tinubu don tell di acting governor of di Central Bank of Nigeria (CBN) to knack new financial sanctions to di ones wey first dey on top Niger Republic.
Di National Labour Congress (NLC) don suspend dia planned strike afta Presido Bola Tinubu chook mouth come get emergency meeting with di Senate.
16 Northern joinbodi no go join NLC for dia strike.
NLC protest don start for different parts of di kontri.
Di supplementary list of ministerial nominees wey pipo don dey wait for go land for Senate today (Wednesday) for screening.
Dj tunez, Wande Coal, Ms Banks, Darkoo, Masego, Skylar Tyla, Lax and even The cavemen na some of the artists wey open stage for Wizkid show wey happen for inside Tottenham Stadium for London.
Governor of Lagos State, Babajide Sanwo-Olu don tok say the state go reduce transport fare for all state transport system (BRT, LAGBUS, and e.t.c) by 50 per cent.
Nigeria Labour Congress don dey ready for dia mass strike wey go start on Wednesday to protest di plenty suffer wey fuel subsidy removal don cause.
President Bola Tinubu go dey broadcast on Monday, to talk to di nation.
Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu don send di list of nominees for him cabinet to di State House of Assembly for screening and confirmation.
Di Senate don tok say e go begin di screening of di 28 ministerial nominees on Monday wey President Bola Tinubu Submit.
One Katsina woman go show for court on top say she allegedly cut her husband manhood
Di police don confirm say di female tok tok pesin ,Priestba Wokocha wey dem kidnapp don free.
Di NLC Don tok say them go start strike on Wednesday, August 2 2023.
60 days after Presido Bola Tinubu siddon for chair as President, him don finally send the list of the names of pipu wey eim want to work with am as ministers give the senate house of we obodo Nigeria.
Di Department of State Services (DSS) don re arrest di former CBN governor wey dey suspension, Godwin Emefiele.
One Federal High Court for Lagos don grant Godwin Emefiele , di Central Bank of Nigeria (CBN) governor wey dey suspension, bail to di sum of N20 million.
Na so pesin go just dey chillax, oo wahala go find you reach chilling spot. David Adedeji Adeleke wey many pipu know as Davido, been post one video for on top social media last week, to take promote the music of Logos Olori wey be one of the new artist wey eim sign.
Pregnant woman, three pikin and 16 odas die on sunday for Ore, Odigbo council local government for Ondo state.
Di Lagos state government wan do burial for 103 victims #EndSARS protest for 2020.
Di Federal Government through di Federal Ministry of Education don increase di school fees for new students wey wan enter Federal Unity Colleges, a.k.a Federal Government Colleges.
Di Federation Account Allocation Committee (FAAC) don share total of N907.054 billion to Federal Government, States, and Local Government Councils.
Di federal government on Thursday announce say dem go close di Alaka-Costain-Iganmu section of Eko Bridge for another 40 days.
FCT Taskforce Don Scata Moto Parks Wey Pipo Wey Dey Beg And Pipo Wey Dey Do One Chance Dey Stay.
For One federal high court meeting for Abuja dem don order di Department of State Services (DSS) say make dem permit Nnamdi Kanu wey bi di leader of di Indigenous People of Biafra (IPOB) access to doctors.
Vice Presido wey bi Kashim Shettima don ask di former federal legislators say make dem support di Tinubu administration, e still tok say di administration really get di interest to change di country for mind.
Di meeting for di National Economic Council [NEC] go shele for Presidential villa Abuja on Thursday.
Di House of Representatives don reject di motion wey tok say make dem stop di rise in di prices of petrol and say make dem return am back to di old petrol prices wey be N488 to N537 per liter.
Di Nigeria Labour Congress and di Trade Union Congress don com out tok say dem nor dey happy wit di way Presido dey add money to di petrol price
Di National Agency for di Prohibition of Trafficking in Persons (NAPTIP) tok say dem don stop women wey dey give babies out to dey beg for Nyanya for Federal Capital Territory.
E be like Nigerians no go get a smooth ride as fuel price go dey increase since fuel subsidy removal.
Di Nigerian Economic Summit Group (NESG) don announce di appointment of Dr. Tayo Aduloju as its next Chief Executive Officer (CEO).
Presido Bola Tinubu don order a review of his government’s conditional cash transfer program for di transfer of N8,000 to pepo to help dem cover up di effects of fuel subsidy removal.
Senator Abubakar Kyari, di Deputy National Chairman (North) of di ruling All Progressives Congress (APC),don become di acting National Chairman for the party.
One Endurance Samuel for Ondo state dey receive treatment for hospital from di hot water her oga wife pour am.
Di Senate don confirm di appointments of di service chiefs wey President Bola Tinubu just nominate.
One Federal High Court for Abuja no gree for wetin di leader of the Indigenous People of Biafra (IPOB), Nnamdi Kanu to wear eim Igbo traditional attire, “Isi Agu” wen he dey custody.
President Bola Tinubu don announce say di Federal Government plan to provide financial help to 12 million low-income families for Nigeria for six months.
President Bola Ahmed Tinubu don write to di National Assembly on top di amendment of di 2022 Supplementary Appropriation Act wey go allow di federal government to fit get N500 billion for palliatives to soft di effect of di petrol subsidy wey dem remove.
Veteran Nollywood actress Cynthia Okereke don kpai.
Dem no small pass 84 Nigerian soldiers and two officers wey come back Nigeria after dem don serve for di ECOWAS Stabilization Support Mission for Guinea Bissau.
Di Lekki Deep Sea Port management don create 153-capacity pre-gate truck park wey go make sure say traffic management control go dey di port.
Senate President Godswill Akpabio on Tuesday announce di heads of some of di committees, like Appropriations, Public Accounts, Ethics, and Public Petitions and Establishment.
Di panel wey Governor Charles Soludo of Anambra State set up to investigate di examination fraud wey Mmesoma Ejikeme, a candidate in the 2023 Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME) dey inside, Mmesoma Ejikeme, don submit di report.
Di Nigerian Army tok say soldiers of Operation Hadarin Daji don rescue 24 kidnap victims and kill four bad guys for firefight inside Zamfara State.
President Bola Tinubu don be di new chairman of the Economic Community of West African States (ECOWAS) for di 63rd Session of di Authority of Heads of State and Government for Bissau, Guinea-Bissau.
Di House of Representatives don set to probe wetin e call illegal selling of Federal Government properties by Nigeria Ports Authority (NPA) and Nigeria Maritime Administration and Safety Agency (NIMASA)
Meta CEO Mark Zuckerberg tok say ten million pipo don sign for dis new threads app, for di first seven hours when dem just start.
If your house no get waste bucket for Lagos, dis news na for you.
Resident doctors don give Federal Government two weeks to answer dem
Di National Emergency Management Agency ( NEMA) don mention 14 states and 31 communities for Nigeria wey go get problem of heavy rain and plenti flood from July 4 to 8.
Di FCT Administration don promise to punish di contractor wey dey run now becos of di four-storey building wey fall and injure nine labourers on Monday afternoon.
Some pepo wey dey stay for Port Harcourt don com out say make dem investige wetin make di building collapse.
Di planned defence of INEC before di Presidential Election Petition Court bin pause on Monday morning.
Di Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) don tok say one Ejikeme Mmesoma change her score con dey tok say na she get di highest score for di 2023 tertiary examination dis year.
Di Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria (IPMAN) and Association of Distributors and Transporters of Petroleum Products (ADITOP) don tok say dem no get any plan to increase petrol price to N700 per litre.
FG don announce July 9 as di new date to re-open di two bridges.
Lagos State Government don announce annual renewal of proof of ownership certificate.
Di IGP don tok say make all police convoys dey obey traffic rules and regulations.
Di Federal Government don declare Wednesday and Thursday wey bi di June 28th and 29th of june 2023 as public holiday for dis year Eid-el-Kabir.
Presido Bola Tinubu don rename some federal airports afta many ogbonge pepo dem.
One Magistrate Court for inside Ibadan, Oyo State don order say make skit maker, Abdullahi Maruff Adisa, a.k.a Trinity Guy go prison becos eim allegedly sexualizing minor for one viral skit video.
One man and three women don injure well well afta one gas explosion for Agege area of Lagos State.
Lagos Deputy Governor Hamzat tok say na lie, eim no tok say eim no be Nigerian.
Di price of cooking gas don reduce by about 300 naira for di month of April and May.
Di Department of State Services (DSS) on Thursday warn Nigerians of terrorists’ attacks as dem wan celebrate Eid-el-Kabir dis period.
LASU best Graduating Student Don Get #10 Million Gift From Sanwo-Olu
Di Special Adviser Presido on Special Duties, Communications & Strategy, Dele Alake tok say President Bola Tinubu "neva approve any salary increase, and dat kind proposal neva reach him front for consideration."
President Bola Tinubu don approve di return of di National Emergency Management Agency (NEMA) to di Office of di Vice President for supervision, in compliance wit their various establishment Acts.
Di Federal Government on Tuesday don set new deadline of July 15 to complete di repairs and re-open of both Eko and Apongbon bridges to traffic.
President Bola Tinubu don appoint new service chiefs for di country.
Di Sultan of Sokoto don tok say 28 June go be Eid al-Adha.
Di Central Bank of Nigeria don lift di limits wey dem put on top domiciliary accounts.
One Federal High Court wey dey Abuja don give immediate order to di Department of State Services (DSS) to grant di Governor of the Central Bank of Nigeria (CBN) wey dem suspend, Godwin Emefiele, all access to eim lawyers and family members as na eim constitutional rights.
Police for Osun State don arrest 28-year-old Kehinde Adesogba Adekusibe wey violate di hate speech policy on social media.
President Bola Tinubu, on Thursday, bin get closed-door meeting with di 14th Emir of Kano and former Governor of the Central Bank of Nigeria (CBN), Sanusi Lamido Sanusi, for di State House.
President Bola Tinubu don appoint eight special advisers
Nigerian Presido Bola Tinubu don tell the Chairman of the Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) Abdulrasheed Bawa, make eim commot for eim office for now until dem finsh to dey chook eye on top the case wey dem put for eim head.
Guinness world records don talk say one Nigerian woman ,don break di record of di longest cooking marathon by one pesin.
Dem don elect Senator Godswill Akpabio of di All Progressive Congress as President of di Senate.
15 Days after President Bola Ahmed Tinubu Siddon for chair a presido, eim don carry biro(pen) take sign say Nigeria students go fit get loan wey no get interest on top for dem to fit pay dia school fees for university.
President Tinubu don Promise to ease di pains of di petrol subsidy removal.
Federal Government don declare Monday, June 12, 2023, as Public Holiday.
President Bola Tinubu on Wednesday swear in Senator George Akume as di 21st Secretary to di Government of the Federation (SGF).
Di Senate go hold eim valedictory session on Saturday, wey go mark di end of di ninth Assembly.
Di Nigerian Governors’ Forum don tanda with President Bola Tinubu's decision to end fuel subsidy payment.
INEC Release List for Governorship Election for Kogi, Bayelsa, and Imo States.
Di Senate don approve President Bola Tinubu request to appoint 20 Special Advisers.
The Nigeria Labour Congress (NLC) don ready to start nationwide strike on Wednesday.
PDP Presidential Candidate, Atiku Abubakar don carry eim first witness come court on Thursday on top di Presidential election mata.
Di meeting between FG and Nigeria Labor Congress (NLC)on top fuel subsidies on Wednesday evening no get head.
Di Central Bank of Nigeria(CBN) don deny tok tok about di devalue of naira to di US dollar.
President and Vice President resume in Aso Rock Villa as Nigerians dey wait official appointments.
Presido Tinubu don tok say under eim administration , di time of fuel subsidy don finish.
Di Founder of DAAR Communications Plc, High Chief(Dr.)Raymond Dokpesi don die.
Dem don swear Ahmed Bola Tinubu as di sixth President of Nigeria.
Lagos State Police don Arrest 2 Yoruba Nation pipo wey dey cause wahala and Oyo State Police arrest 5.
Di Nigeria Police Force don tok say Federal High Court for Awka no sack IGP of Police.
Di Supreme Court don dismiss case wey PDP dem tok say President- elect Bola Tinubu and eim Vice President- elect Kashim Shettima no qualify.
Everybody eye don dey on top supreme court as na today dem go drop judgement on top di case wey PDP carry against APC, Bola Tinubu and Kashim Shettima and e go happen today.
President Muhammadu Buhari don carry national honours give President-elect Bola Tinubu and Kashim Shettima, the vice-president-elect.
FG don approve policy wey go let ATM card to fit be I.D card.
Before eim first tenure go end Governor Babajide Sanwo-Olu don announce di dissolve of Lagos State executive council and di sacking of all di political officeholders and aides.
Di bill to compensate #EndSARS victims don pass second reading for senate.
Police don release Afrobeat Musician, Seun Kuti on bail.
South-East Governors don agree say dem go name the Second Niger Bridge after President Muhammadu Buhari.
Presido Muhammadu Buhari don commission di 2nd Niger Bridge and six other big projects wey di Federal Ministry of Works and Housing don complete for di country.
Di Supreme Court On May 26 go judge di case of Peoples Democratic Party, PDP, wey dem put on top President- elect, Sen. Bola Tinubu and him Vice-President elect.
Di Largest Single Train Refinery For Di world Go Start Work For Lagos.
Two Ad-Hoc staff of Eko Electricity Distribution Company(EKEDC) shock kpai for wen dem dey work.
FG go dey carry Nigerian passports go dey give pipo house.
Resident Doctors for Naija don suspend dis strike for 2 weeks
50-year-old man rape eim neighbor 12 -year-old daughter and 24- year -old man rape 6-year -old
Buhari don give 65 ex- corpers immediate work for Federal Government work and scholarships.
Nigeria Police don find and carry di police officers wey beat okada man for Abule- Egba area for Lagos State.
Fedral Ministry of Works don confirm di closing of Apapa side of Marina Bridge
Nigeria Info Lagos don carry di award for best radio station of di year for di first Nigeria Broadcasting Awards wey happen on Wednesday night for Lagos.
Two staff members of di United States Embassy in di state don kpai by gunmen
Presido Muhammadu Buhari don come back to Abuja afta him join oda world ogas wen dem go di coronation of His Majesty, King Charles III as di King of di United Kingdom and Leader of di Commonwealth.
Presido Buhari dey tell governors elect say make dem do wetin dem promise wen dem dey campaign.
Di Nigerian Association of Resident Doctors(NARD),tok say dem go start five-day warning strike on Wednesday
Afrobeats musician, Seun Kuti don by himself go surrender for Lagos State Police Command for Ikeja
Nigerian chef, Hilda Effiong Bassey a.k.a Hilda Baci don break Guinness World Record for longest cooking time by an individual
Di Inspector-General of Police, IGP Usman Alkali Baba,don tell Commissioner of Police, Lagos State Command make im go arrest the Afrobeat singer, Seun Kuti, as im beat police officer wey wear uniform.
The Minister of Labour and Employment, Dr. Chris Ngige, don yarn say him and other ministers dey collect N942,000 afta dem pay dia tax and the only allawee wey dem dey collect na when dem travel go do work.
Di National Economic Council (NEC) announce on Thursday for Abuja say im don decide to delay di remove of petrol subsidy wey dem bin plan for June 2023.
Nigerians go ready to see three-day movement restriction for di whole country as the National Housing and Population Census go soon start.
Di Nigerian government don tok say im go comot im citizens from di war wey dey Sudan with 40 buses for $1.2 million.
Lagos Don Start To Remove Illegal Buildings For Banana Island
Di Commissioner of Police, Lagos State Command, CP Idowu Owohunwa, don order di sharp sharp remove of di Divisional Police Officer (DPO), Olosan Mushin, on top alleged misbeave for im station
Di National Drug Law Enforcement Agency, (NDLEA), don warn skit makers to stop to dey use dia logo and jackets in dia production.
Two of di Chibok schoolgirls don escape from di pipo wey kidnap dem.
NYSC Don Ask Female Married Corps Members To Go Back To Di State Wey Dia Husband Dey Stay
Presido-Elect Bola Ahmed Tinubu, don tok say make pipu no believe the tok-tok wey amebo pipu dey tok say eim no well.
President Muhammadu Buhari don come back Abuja after im eight-day official visit to di Kingdom of Saudi Arabia, where him bin join do di Umrah (Lesser Hajj).
To celebrate dis year Eid el-Fitr,di Federal Government don declare Friday, April 21, and Monday, April 24, 2023, as public holiday.
Di Debt Management Office (DMO) don dismiss tok tok pipol report wey tok say Nigeria neva fit dey pay di loan to China.
Di Nigeria Electricity Regulatory Commission (NERC),tok say e go soon provide four million prepaid meters to electricity consumers for di country.
The Lagos State Government go arrest one Uzuokwu Solomon bcos im do wayo call to di people wey dey answer emergency
Kenyan Police don arrest one man wey be Pastor of Good News International Church because eim tell eim followers make dem no chop food or drink water so that dem go fit meet Jesus.
Dino Melaye, wey be former senator, of Kogi West Senatorial District, don win the Peoples Democratic Party (PDP) governorship primary election for inside Kogi.
KPMG wey be company wey dey chook eye ontop how economy dey do, don come out come tok say for inside 2022 37.7 percent of pipu inside we country naim no get work.
© Copyright 2023 Steam Broadcasting and Communications Limited. Powered by Aiir.