On Air Now

Kulele Zone

3:15pm - 6:00pm

Akuku-Toru Chairmo Vow Say Hin Go Make Reading, Learning Beta For Pipu

Di council boss hail everybody wey dey work to improve reading and learning for Akuku-Toru

Di Chairmo of Akuku-Toru Local Government Area for Rivers State, Aboiya-a Bob-Fubara, don tok sai im administration go put more effort to make sure say pipu for the area sabi read, write and use knowledge well.

Bob-Fubara tok dis one for message wey im send to mark International Literacy Day wey dem dey observe today, September 8.

Di council boss hail everybody wey dey work to improve reading and learning for Akuku-Toru, as e promise say im administration go put money and support into school programmes wey go help students and teachers get beta knowledge, including digital skills wey dem fit use for everyday life.

He also don follow students tok and other pipu for di area make dem grab every chance wey go help dem use wetin dem don learn do beta things for dia everyday life.

As part of di activities to mark di day, di council boss go today celebrate and give reward to students wey do very well for di exams wey dem write after one-month summer lesson for Abonnema.

For di statement, Bob-Fubara tok sai di closing ceremony na part of di promise wey e make to give special attention to students wey join di holiday lesson.

He tok sai when dem put money and effort for young pipu today, e be like seed wey dem plant wey go bring better result tomorrow.

Di chairman add say im administration serious about making sure say students from Akuku-Toru get di knowledge and skills wey go make dem stand well-well beside oda students for anywhere.

Bob-Fubara also throw twale gjve di organisers, teachers and students of di summer lesson for dia hard work, good performance and cooperation throughout di programme.

Comments

Add a comment

Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 30°C | Low: 25°C