Some of us when we know di drug wey dey work for us, we go dey use am everytime and without doctor prescription. That one na drug abuse.
Whenever u go see ur doctor, anything wey no clear to u ask am questions like wetin e dey treat u for?, If eim prescribe drug to u ask am wetin di drug dey work for, ask am for side effects of di drug.
Doctor Fred tok say if e dey hard you to piss as man or you see blood for your urine, Abi back dey pain you, go see your doctor fast fast oo. If it be prostate cancer. #chookmouth #goodlifenasense
Ontop #bodimata wit Chief Suo and Ratata ,Doctor Fred tok say if u dey smooke shisha for one hour, u dey smoke 40-400 cigarettes.
Ontop #unawakeup wit Ratata and Chief Suo. Ratata ask Dr Nimmie wey be family doctor and child advocate, say which age pikin suppose to dey use phone?
Dis week na #childrensweek ontop #bodimata wit Chief Suo and Ratata . Favour ask Dr Fred how many months we suppose to dey deworm.
If u get pesin for ur family wey dey depressed, e fit also make u dey depressed and if u dey suffer abuse, poverty u fit also get depression.
Mental health challenge no dey happen to only pipo wey no wear clothe for road, anybodi fit get mental challenge, even children dey get mental health challenge.
Ministry Education for Lagos don close Redeemers Nursery and Primary School for Ogba, sake of 5 year old pikin wey die for di school when eim dey swim.
General Overseer of Redeem Christian Church, Pastor Enoch Adeboye, say e no tell Christians make dem buy gun, say Christians no need guns. He say Samson for Bible no fight wit AK-47.
Governor of Ondo State, Akeredolu say di pipo wey dey cause plenti badness for Naija, no be Nigerians.
Police Public Relations Officer for Anambra, Ikenga Tochukwu, confirm di early-morning attack wey shele for Awka, Anambra. He say dis attack happen for around 4:30 am for Awada for Idemili North Local Government Area of the state.
Naija economy grow at 3.11 percent for di first quarter of 2022, Q1’22, leading banks for di kontri don report 24.7 percent and 18.6 percent increase for revenue and profits for di same period.
Dem dey sell up to 63 Million laptops, and phones dem for Nigeria evri year, na according to data from Original Equipment Manufacturers.
Anambra Governor, Charles Soludo don declare curfew for 8 local government areas for di state, Aguata, Ihiala, Ekwusigo, Nnewi North, Nnewi south, Orumba North, Orumba south.
Federal government wan put new tax ontop phone calls for di the country, say dem wan do free health care for pipo wey no fit afford am for Naija.
© 2022 Steam Broadcasting and Communications Limited. Powered by Aiir.