On Air Now

Evening Oyoyo

6:00pm - 10:30pm

Senate Want Make CBN Shift Di Deadline For Old Money

Senate don come out on Tuesday, come dey beg CBN say make shift di deadline wey dem put wey be 31st of January go July 31st wey we go stop to use di old naira note.

When di oga pata pata of all Nigeria bank, come out last year October, come tok say from January 31, 2023, we go stop to dey use di old money, senate pipo bin beg dem last year December, say make dem shift di deadline wey we go stop to use di old money go June 30, 2023.

But still, di strong head wey CBN oga do ontop di deadline of di new naira note, na him make  Senator Sadiq Umar wey dey represent APC Kwara North, carry di matter come Red Chamber on Tuesday, so dat dem go fit shift di date go July 31, 2023.

All di Senator wey chook mouth for di matter tok say, dem gree with wetin Senator Sadiq tok, say make dem shift deadline, say no be all dey banks don get di new naira note and ATM for di whole of we countri still dey pay di old one.

Di Senate President, wey be Ahmad Lawan, tok say make dem vote and all of di Senators support make dem shift di date from January 31, 2023, go July 31, 2023.

#chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C