
U gree say Naija music na why Oyinbo pipo no dey see us as 419 again?
🎵 Mo like Jesu gan singer Dekunle Fuji enta we studio follow Yaw about eim music
Why e be say good pipo dey always die first?
Ontop #youandyaw Yaw siddon tok wit Baba Dee ontop Sound Sultan new album(Reality Chq)
Up to N5 million loan dey for Okada riders to start new business - Hon Sola Giwa
Ontop #youandyaw Yaw siddon tok wit Special adviser to Lagos State Governor ontop Transport mata wey be Honorable Sola Giwa.
No dey follow police argue, just get evidence
Inspector of General of Police say serious punishment dey for anybodi wey harass police.
Yaw follow Otu Njama Tok about how Nico Mbarga "Sweet Mother" promote pidgin language.
Ontop #youandyaw Otu Njama followYaw tok about how di song “Sweet Mother” wey Nico Mbarga sing, say na one of di songs wey help promote pidgin English for oda kontries for di world.
Shey Nigeria dey deceive dem selves ontop fight to stop Insecurity
Ontop #youandyaw wit Yaw, You gree wit Robos man say we dey do well ontop security situation for di kontri, dat na why our Presido dey go deliver lecture on security for Liberia?
U Gree Say Fela Na Prophet, As Things Wey Eim Sing Tey Tey Still Dey Happen For Naija?
Ontop #youandyaw Yaw say wetin Fela dey sing for eim songs that time still dey happen for di kontri, e be like say di kontri dey even go worse.
Where all di security pipo dey when ISWAP attack Kuje prison?
Yaw say eim shock say we Presido Buhari dey surprise say ISWAP get liver enta Abuja come release pipu for Kuje prison. But the surprise no make Presido cancel eim waka go senegal for meeting.
Shey poverty fit make u cut and sell ur toe?
Ontop #youandyaw, Yaw say him hear say for Zimbabwe, young men dey cut and sell dia big toe for $40,000 and small toe for $20000 and na ritual for money but na 10yrs dem go live.
Shey make dem ban Okada pata pata for Lagos state?
Ontop #youandyaw, Yaw tok about di sound engineer wey okada riders beat to death ontop 100 change for Admiralty lekki phase 1 on Thursday 12, May 2020.
If to say Osinachi Nwachukwu speak up she for no die - Patience Ozokwo
Mama G Patience Ozokwo follow Yaw yarn about about domestic violence.
Wetin fit make u beat ur partner?
Ontop #youandyaw with Yaw one caller say na di character of women dey make men dey beat them
Shey pass mark suppose dey for politicians if dem no do well?
U agree with Yaw say pass mark suppose dey for politicians, to know if dem dey do well or if dem no dey do well!
2022 Headies go happen for America, na bentley dem wan give next rated
Yaw tok to headies oga Ayo Animashaun, ask am why he wan carri headies go America.
Where Leah Sharibu Dey?
Reno Omokri tok with Yaw about di state of Naija and Leah Shabiru wey still dey with boko haram
Shey Nollywood dey responsible for Ritual Killings for Nigeria?
House of Reps dey blame Nollywoood ontop ritual killings wey dey happen for Naija. Wetin u think?
Kano school proprietor kidnap and kill student
Wonders shall neva end for dis kontri o😢 School principal kill eim 5 year old student for Kano😭 and Bury de girl for di skool. @yaw dey ask where we get am wrong for Nigeria🤔#chookmouth
Nigerians go get your Permanent Voters Card(PVC)!!!
As 2023 elections dey near, make all of us go get our PVC, so we go vote di right pesin.
Shey Goodluck Jonathan fit be Naija next presido?
We dey hear say Goodluck Jonathan wan come back be president, but he neva tok am. You think say he fit be president again?
How u fit save moni for 2022
Yaw dey tell us say moni wey u no fit dash pesinn, no borrow de pesin moni oo
© Copyright 2026 Steam Broadcasting and Communications Limited. Powered by Aiir.