Lagos State Environmental and Special Offences Unit (Task Force) don gbab 668 commercial motorcycles (okada) inside one-week operation raid wey dem do.
Lagos State Ferry Services (LAGFERRY) don talk say dem don transport over 2.5 million passengers inside last five years, as part of di state plan to expand water transportation.
Chairman of Air Peace, Mr. Allen Onyema, don raise alarm say Nigeria airline industry fit collapse if Federal Government go ahead with new tax regime wey reintroduce customs duty and VAT on imported aircraft, spare parts and ticket sales.
President Bola Ahmed Tinubu don express deep sorrow over di death of Emir of Zuru for Kebbi State, Major General Muhammadu Sani Sami (rtd), Gomo II. Tinubu describe di loss as “big blow to Nigeria.”
National Security Adviser, Mallam Nuhu Ribadu, don announce say dem don capture two top leaders of di Ansaru terrorist group – one Al-Qaeda-linked faction wey don dey terrorise Nigeria for over ten years.
The ruling party, All Progressives Congress (APC), don waka comot from Saturday bye-election with 12 seats out of 16 wey dem contest for 12 states. Other parties – APGA, PDP and NNPP – share the remaining four.
© Copyright 2025 Steam Broadcasting and Communications Limited. Powered by Aiir.