On Air Now

Closing Joli Joli

6:00pm - 11:00pm

Workers Dey Tok Say Dem No Go Gree As Deir Company Plan To Pay Dem With Old Naira Note

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Plenty pipo wey dey work for one company wey dey for Gunduwawa for Kano State come out on Sunday come tok say dem no go gree as dia company dey plan to pay dia January salary with old naira note wey go expire dis month.

Di pipo wey dey work for Lee Company tok say dis I no go gree protest wey dem dey do na to make Central Bank of Nigeria change di deadline wey be January 31 wey dem choose say we no go fit use di old naira note again.

Dem gather for di gate of di factory, come dey tok say most pipo wey dey do business don order deir workers make dem stop to dey collect di old naira note from January 23.

But di director for di company, wey be,  Ahamad Haruna Danzago, tok say di company dey pay with old naira note as dem no get di new one.

Na President Muhammad Buhari na im bring out di new N200, N500, and N1,000, on 23 of November 2022, for State House.

Plenty Nigerians still dey spend di old naira note as di new one scarce and bank ATMs still dey give di old ones for di first three weeks of January 2023.

#chookmouth


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny

    High: 38°C | Low: 27°C