On Air Now

Closing Joli Joli

6:00pm - 11:00pm

Wike Beg Oga Tinubu to Give Am Imo And Kwara to Deliver For 2027

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

"As I dey go now, I go beg di DG and oga Presido make dem add two more states for me to deliver.” Wike bin talk this one.

Minister of di Federal Capital Territory (FCT), Nyesom Wike, don beg President Bola Tinubu and leaders of di All Progressives Congress (APC) say make dem give am two more states to arrange political waka for Tinubu re-election ahead of di 2027 general elections.

Wike deh ask for Imo and Kwara states, as him make mouth say him don finish di political work wey dem give am for Rivers State and di FCT, and him dey ready to collect more work.

Di FCT minister talk dis one during him town hall meeting with pipu weh deh live for Gokana Local Government Area of Rivers State.

Inside dis town hall meeting, Wike come beg Oga Presido and di Oga kpata kpata of di APC Presidential Campaign, Abdul’aziz Yari, say him hand strong well well to handle Imo and Kwara state.

“Una know say dem bin give me Rivers and FCT, but truth be say, I don finish work for dis two states. Work don finish there. As I dey go now, I go beg di DG and oga Presido make dem add two more states for me to deliver.” Wike bin talk this one.

Wike chook eyes on top Imo and Kwara as di two states wey him want, because say plenty wahala weh deh APC for di two states.

“I hear say dem dey get ogbonge kata kata for Imo, according to wetin dem tell me. So I go like make dem send me go there, make I deliver Imo for oga Presido.” Wike still talk.

Dis beg weh Wike beg Oga presido deh come as political waka waka dey gather plenty noise inside  APC ahead of di 2027 general elections.

If oga Presido agree to wetin Wike talk, e go means say Wike go get plenty work for him hand, as Imo and Kwara go join Rivers State and di FCT.

Like dis, Presido and Abdul’aziz Yari never still chook mouth for dis beg weh Wike deh beg.

Comments

Add a comment

Onitsha Weather

  • Onitsha

    Thundery shower

    High: 38°C | Low: 24°C