On Air Now

Kulele Zone

2:00pm - 6:00pm

US Don Donate $1 Million To Support Pipo Wey Flood Affect For Inside Naija.

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?
U.S Ambassador For Naija, Mary Beth Leonard

Di United States don announce say dem go support di pipo wey flood affect inside Naija wit di amount of 1 Million Dollar.

Di person wey dey represent United State for inside Naija aka U.S Ambassador, Mary Beth Leonard tok say body no sweet dem at all wit wetin dey go on for inside Naija as plenty plenty pipo don die and many oda pipo too don loss dia houseand notin to even chop as water carry eveything go but say di U.S stand gidigba wit di pipo of Naija for dis hard time.

Di U.S Agency for International Development aka USAID na dem dey provide 
dis money to carry support pipo wey di flood palava affect.


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny

    High: 38°C | Low: 27°C