On Air Now

Closing Joli Joli

6:00pm - 11:00pm

Unemployment Rate For Naija Go Soon Enta 41% inside 2023 - KPMG

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

KPMG wey be company wey dey chook eye ontop how economy dey do, don come out come tok say for inside 2022 37.7 percent of pipu inside we country naim no get work.


Them come carry dia eyeglass look the mata come tok say with the way things dey go as the country economy do waka like person wey no get anywhere wey eim dey go, plus 4-5 million pipu wey go commot for school come dey find work, unemployment fit enta  40.6 percent.

KPMG come still tok say with the way dem they see the mata of inside 2023, wey Federal Government wan commot fuel subsidy and the plan wey the government get to take make money, go still add to the pressure wey go dey for 2023.

The way come dey be KPMG come tok say the way wey the economy take dey go make things hard for the government wey want enta power.

Because the money the government dey make no go reach for dem to do thing and still pay the gbese wey full for ground.


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny

    High: 38°C | Low: 27°C