
President Bola Tinubu don announce say former presido Muhammadu Buhari don die.Buhari die for Sunday around 4:30 evening for London after e don sick for long time.
For one statement wey come out on Sunday from di Special Adviser to di President on Information and Strategy, Bayo Onanuga, Tinubu describe di former presido as "patriot, soldier and real statesman."
Di statement talk say:
"Na with heavy heart I take hear di tori say His Excellency, President Muhammadu Buhari (Retired), GCFR, my predecessor, don die today, Sunday, July 13, 2025, for one hospital wey dey United Kingdom.President Buhari na real patriot, soldier and statesman. Wetin e do for Nigeria go remain forever. E serve Nigeria with full dedication—first as military head from January 1984 to August 1985, then again as elected civilian president from 2015 to 2023. Wetin guide am na duty, honour and strong belief for unity and progress of di country.”
President Tinubu, wey just return to Nigeria on Saturday after im waka go Brazil and St Lucia, also talk say he don reach out to Buhari family to tell dem sorry.
Di statement still talk say:
"President Tinubu don talk to Madam Aisha Buhari, wey be Buhari wife, and e don tell her sorry from hin heart."
President Tinubu don also order say make Vice President Kashim Shettima go UK go follow Buhari body return back to Nigeria.
Tinubu still order say make dem put Nigeria flag half for pole for seven days to show respect to di former president wey don kpai.
Buhari na former military ruler from 1984 to 1985, and civilian president two times for 2015 and 2019.
E die at di age of 82.