On Air Now

Family Parole

9:00pm - 11:00pm

The Olubadan Of Ibadan Don Kpai Afta Shikini Illness

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

The 42nd Olubadan of Ibadan Land, HRM Oba Moshood Olalekan Balogun, don go join him ancestors for yonda on Thursday, March 14, 2024 at the University College Hospita (UCH), wey dey Ibadan after tintini malaria.

Remember say na 2 years di Kabiyesi spend for throne of him Baba Baba dem, as e collet the Staff of office in March 2022 from the Oga patapata of Oyo State, Governor Seyi Makinde. 
The tori, as we take hear am from the Chief tok tok person to the late Kabiyesi,  Sulaimon Olanrewaju, be say the King been kpai for University College Hospital wey pipo dey call UCH after shikini hours wey dem admit am for the Hospital on Thursday evening.

According by our ofofo pipo dem, dem tok am say di Kabiyesi wey don go join him ancestors for yonda been enta Hospital on Wednesday morning. As di mata take be sef, on Monday, Baba still dey kakaraka for house, as pipo go greet am congratulations for sitting gidigba for 2 years ontop King chair, and Tuesday, baba no go out as kekere malaria been dey touch am for bodi. Wen e reach Wednesday morning, after di mata don dey big small small,  dem take am go Hospital. 
As di unique ogbonge system of how dem take dey crown King for Ibadan, Oba Owolabi Olakulehin, di current Balogun Olubadan of Ibadan, wey dey next in line to chop King, go waka climb King Chair afta di traditional 21 days of mourning, as di next Olubadan of Land.

Na so we see di mata o. How you see am? #ChookMouth


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny intervals

    High: 36°C | Low: 25°C