On Air Now

Oga Madam Office

10:00am - 2:00pm

Terrorist Don Release 23 Remaining Abuja-Kaduna Train Passengers

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?
23 pipu wey still dey for the hand of the terrorist wey kidnap dem for the Abuja-Kaduna train attack don finally gain dia freedom.

Naija military say dem don make sure say gbege pipo release di remaining 23 passengers from di Abuja-Kaduna train attack.

Secretary to di Chief of Defense Staff Action Committee Professor Usman Yusuf tok dis one for statement on Wednesday.

For di statement e tok: “I dey happy to announce to Naija pipo and di world say at 4:00pm, October 5,2022. Di seven-man Presidential Committee wey Chief of Defense Staff (CDS) lead, General L E O Irabor, make sure dem release all di 23 remaining passengers wey Terrorists hand afta di Abuja- Kaduna train attack on 28-3-2022.

How u see di mata? #chookmouth


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Thundery shower

    High: 36°C | Low: 26°C