On Air Now

Non Stop Music

11:00pm - 6:00am

Supreme Court Go Judge On Top Tinubu and Shettima Candidacy Today

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Everybody eye don dey on top supreme court as na today dem go drop judgement on top di case wey PDP carry against APC, Bola Tinubu and Kashim Shettima and e go happen today.

Dis case wey PDP carry dey find di disqualification of Tinubu and Shettima as dem tok say Shettima bin get double nomination wey eim alleged double nomination no follow some of di sections of di electoral act 2022.

PDP dey argue say Shettima nomination to contest for position of vice presido still dey contest for Borno central senatorial seat and dis one no follow di law.

Make we still remind una say Federal High Court and Court of Appeal bin don first tok say PDP no get locus standi to start case. 
  
How una see di mata?
#chookmouth  


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Thundery shower

    High: 35°C | Low: 25°C