On Air Now

Oga Madam Office

10:00am - 2:00pm

Subsidy Removal: NLC go Start Nationwide Strike on Wednesday

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

The Nigeria Labour Congress (NLC) don ready to start nationwide strike on Wednesday.

FG bin get meeting with TUC on sunday and NLC no go dat meeting as dem tok say until FG return to di old prices of fuel, e no get wetin dem wan discuss. 

Dis one dey happen because of di increase in fuel price since Presido Bola Tinubu tok say "fuel subsidy is gone".

Di NLC presido, Joe Ajaero come out tok say federal govenrment amd di Nigerian National Petrolrum Company(NNPC) get until Wednesday to carry fuel price go backk where e first dey. He still tok say if dem no do am, NLC go start indefinite nationwide strike and protest.

On top dis one, tok tok pesin for federal government, Dele Alake com out tok say government go still try reach NLC before dia next meeting wey go happen on Tuesday.


How una see di mata?
#chookmouth    


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Thunder storm

    High: 36°C | Low: 25°C