On Air Now

Una Wake Up Show

6:00am - 10:00am

Senate Don Tell CBN Make Dem Chook Eye Again For The New Cash Withdrawal Policy.

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

CBN drop one policy for November wey tok say dem pipu no go fit dey withdraw money the way dem take they withdraw like before. And dem yarn say na 9 January, 2023 dem wan start dis new waka.

The waka way CBN tok say go reduce the amount of cash wey dey pipu hand and even give gbege pipu wey dey do kidnapping as dem go get problem ontop the money wey dem dey collect from the pipu wey dem kidnap.

But Naija house wey arrange law, wey be Senate don tell  the Central Bank of Nigeria make dem chook eye ontop the new withdrawal limit wey dem don set. Because plenti naija pipu dey vex with this one wey dem set as the new withdraw limit.

The join bodi on top Banking and Finance for senate, also yarn say dem ready to follow CBN back to back, just to make sure say dem go fit do the withdrawal limit the way wey be say e go fit dey change with how mata be.

For ontop, the new cash policy wey Central Bank of Nigeria drop dem yarn say make bank only dey load any note wey big pass N200 inside ATM. And na only 20,000 Naira you go fit to withdraw per day from ATMs and POS shop.

Dem come yarn for special case wey be say individuals and corporate organisations go need cash wey reach millions, The only amount wey dem fit to withdraw from bank no go pass N5,000,000.00 and N10,000,000.00 for the individuals and corporate organisations, respectively. But conditions follow this one oooo.

Dem go also need to submit something for CBN portal to fit do this one. 

A. Valid means of identification of the payee (National Identity Card, International Passport, Drivers License.)

B. Bank Verification Number of the payee. 

C. Notarised customer declaration of the purpose of the cash withdrawal. 

D. Senior management approval for the withdrawal by the Managing Director of the drawee, where applicable. e. Approval in writing by the MD/CEO of the bank authorising the withdrawal.

E. Approval in writing by the MD/CEO of the bank authorising the withdrawal.

This one go start on the 9th of January 2023 and CBN come also advise banks dem say, with this new policy dem go need to try dia best to make sure say e go siriri werere, and coma or mago mago no go dey inside. And dem go need to ginger dia customers to use another way apart from withdrawal ( internet banking, mobile banking apps, USSD, cards/POS. eNaira, etc.)take dey run dia transactions 


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Thundery shower

    High: 36°C | Low: 26°C