On Air Now

Football Republik

2:00pm - 8:00pm

Rivers APC Tell Fubara: Make Peace or Get Impeached

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

The Rivers State chapter of All Progressives Congress (APC) don warn suspended Governor Siminalayi Fubara say na only better reconciliation fit save am from impeachment.

Tony Okocha, wey be chairman of the APC caretaker committee for Rivers, yarn this one for press conference wey happen for Abuja on Tuesday. According to am, Fubara never do anything serious to settle with the lawmakers wey dem elect inside the state.

"I go talk am straight, no reconciliation dey happen for Rivers right now. The suspended governor never try to settle with the lawmakers. Na only real peace fit save am from impeachment. Supreme Court judgment still dey ground," Okocha talk.

As the matter dey hot, youth groups from Rivers State don dey beg President Bola Tinubu make e restore democratic government for the state and bring back Fubara before Democracy Day on June 12.

Make we no forget say on March 18, 2025, President Tinubu declare state of emergency for Rivers, suspend Governor Fubara, him deputy Prof. Ngozi Odu, and even the members of Rivers House of Assembly. Na Vice Admiral Ibok-Ete Ibas (retd) dem appoint as sole administrator for six months.

All this wahala start because of serious gbege between Fubara and former governor/Minister of FCT, Nyesom Wike, as both of dem dey drag who get final say for the state.

Even as PDP governors don carry the matter go court, meetings between Tinubu, Wike and Fubara recently don show say peace fit dey on the way.

But Okocha no gree. E talk say even if Fubara enter APC, e no mean say e go wash clean. "APC no be dustbin wey people go dump their political wahala. If you join APC, e no mean say your past sins go vanish," he talk.

E still add say, "Fubara never even talk to me. If he wan enter APC, make e follow due process. Nobody from him ward don bring any info say he wan join us."

When dem ask Okocha whether the meeting between Fubara and Tinubu dey worry am, he laugh say APC no dey shake.

"How that one take concern me? Even Chief Osoba go see President during Sallah. So e no mean anything," he talk.

Meanwhile, youths under the umbrella of South-South Youths Initiative and Coalition of Rivers State Youth Bodies don blast President Tinubu action. Dem say the suspension of Fubara and other elected officials na big slap to democracy.

"For this Democracy Day, we dey reflect say our democracy no dey balance again. Wetin happen for Rivers State no make sense and e dey unconstitutional," na wetin the statement from Imeabe Oscar, chairman of the youth coalition, talk.

Dem beg President Tinubu say make e do the right thing and return democracy back to Rivers by reinstating all the suspended elected officials.

The political gbas gbos for Rivers never end – we go dey bring una updates as the matter unfold.


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Thunder storm

    High: 29°C | Low: 23°C