On Air Now

Non Stop Music

11:00pm - 6:00am

Resumption Order: We Dey Wait for Our Lawyer Advice –ASUU

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

The Academic Staff Union of Universities (ASUU) tok say dem dey wait for dia lawyers to give dem professional advice, sake of say the National Industrial Court of Nigeria’s (NICN) order wey say make dem end the strike.

The president of the union wey be Emmanuel Osodeke tok dis one on Wednesday.

The union don dey push for beta academic environment and the welfare of dia members.

Some of the lecturers' demands na:

  • The adoption of its proprietary University Transparency and Accountability Solution (UTAS) in paying the wages of lecturers, rather than the Integrated Payroll and Personnel Information System (IPPIS) used for paying other federal government workers.
  • The publication of the white papers on visitation panels to federal universities.
  • The release of the balance of one tranche of the Revitalization Fund.
  • The release of two outstanding tranches of the Earned Academic Allowances (EAA).
  • And an amendment to the law of the National Universities Commission (NUC) to check the proliferation of universities, especially by state governments.

Di federal government introduce di suit before di industrial court, say make dem stop the ASUU strike as both parties no wan agree with each oda.

Di minister of labour and employment request am, the NICN don ask make dem end di strike.

Justice Polycarp Hamman tok say ASUU no fit go strike when government don gree with "some of the things wey make sense" from dia before agreement.

Him praise di labour minister wey be Chris Ngige as eim act for di national interest becos say him carry di matter go National Industrial Court of Nigeria.

The trial judge tok say di strike don cause damage wey dem no fit repair to public university education inside Nigeria.

He also cancel the claim wey di defendant's counsel tok say, wetin cause di strike na bcause say government don too break di agreement with ASUU.


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny intervals

    High: 38°C | Low: 27°C