On Air Now

Oga Madam Office

10:00am - 2:00pm

Resign Now Or We No Go Support Atiku - Wike Gang Wan Commot Hand For Atiku Campaign

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Rivers State Governor, Nyesom Wike gang for inside Peoples Democratic Party, don come out come tok say dem no dey join hand for Atiku campaign until the chairmo of the party Dr Iyorchia Ayu commot for chairmo chair.

After the meeting former chairmo of the party, Chief Bode George come out come tok the long and short of the meeting.

Oga Bode George tok say make senator Iyorchia Ayu commot for the chairmo position wey somebody from south come takeover.

Some of the PDP members wey dey the meeting na  former Attorney General of the Federation, Mohammed Adoke, Governor Seyi Makinde of Oyo State, former Governor Olusegun Mimiko of Ondo, former Governor Ayodele Fayose of Ekiti State, former governor of Cross Rivers State, Donald Duke

Others pipu na; PDP Chieftain, Olabode George, former senator Jerry Gana, former Deputy Speaker of the House of Representatives, Chibudom Nwuche, and Senator Suleiman Nazif.

With all this drama wey dey happen for PDP shey dem go fit arrange dem self before 2023 election campaign go start on September 28.


 


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny

    High: 38°C | Low: 27°C