On Air Now

Una Wake Up Show

6:00am - 10:00am

Reps Don Gree Make Presido Buhari Borrow One Trillion Naira

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

House of Representative don gree make Presido Muhammadu Buhari borrow N1 trillion from Central Bank of Nigeria (CBN) so dat him go fit pay for di 2022 extra budget.

Di join body wey dey chook eye ontop Finance, Banking, and Currency; and Aids, Loans, and Debts Management for inside di house wey dey make law gree make presido borrow di money wey he want.
But, dem say dem no go chook mouth for di matter of N22.7 trillion Ways and Means Advances wey Central Bank of Nigeria borrow federal government until dem side down look di matter wella.
Remember say na for December Presido Buhari write give National Assembly say make dem give am di loan wey di country go pay back in 40 years time with interest. 
But some Senators no gree say make him tell dem wetin he use di money wey him collect for deir hand before do.
Ways and Means Advances na one Law for CBN wey tok say dem go fit borrow federal government money and di money wey dem fit give government no go pass five per cent of di money wey government make di year before.
Di N22.7trillion Ways and Means Advances wey government collect from CBN hand pass wetin government make for 2021 and 2022, and sabi pipo ontop money matter don tok say wetin CBN and Buhari government do dey illegal.

#chookmouth


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Thundery shower

    High: 36°C | Low: 26°C