On Air Now

Non Stop Music

11:00pm - 6:00am

Presido Buhari Don Come Back From London

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Presido Muhammadu Buhari don come back to Abuja afta him join oda world ogas wen dem go di coronation of His Majesty, King Charles III as di King of di United Kingdom and Leader of di Commonwealth.

Di Nigerian leader come back to Abuja on Tuesday evening, him stay small afta di coronation for like one week becos of hm bodi mata.

Oga Presido spokesman, Mr Femi Adesina tok for one statement for May 10 say di Presido go dey London for extra one week becos of im dentist wey tok say im go need to see our Presido face to face

As Presido dey London , im follow dey for Commonwealth Leaders Summit where him still tok how him happy for dii way wey elctions for naija take go. him tok dis one becos of di way plenty pipo come out come vote and how peaceful everywhere dey.

Di event focus for di future of di Commonwealth as a bodi and di role of di youth.

As Presido Buhari land abuja, na him Chief of Staff, Prof. Ibrahim Gambari , di Minister of di Fedral Capital Teritory(FCT) Malam Musa Bello, and oda security ogas dem.

How una see am ?

#chookmouth


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 25°C