On Air Now

Closing Joli Joli

6:00pm - 11:00pm

Presido Bola Tinubu Don Sharply Suspend Betta Edu

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Presido Bola Tinubu don gree make dem sharply suspend di Minister of Humanitarian Affairs and Poverty Alleviation, Betta Edu.

Presido tok-tok pesin, Ajuri Ngelale, yarn dis tori for one statement on Monday afternoon.

Di statement tok say, "Di President still direct di Executive Chairman of di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) make eim  chook mouth for everi-everi wey  involve di Federal Ministry of Humanitarian Affairs and Poverty Alleviation, plus one or two ogbonge agencies wey dey under dem.

Di Minister wey dem don suspend go handova to di Permanent Secretary of di Federal Ministry of Humanitarian Affairs and Poverty Alleviation. 

Dem go carry out total checkup for di financial system and arrangement of di social investment program. Dem go chook eye well-well, so dem go fit change tins for di institutions and dia programs, to make sure say dem wipe out any wayo-wayo wey dey, so dat e go better for di people wey dey under dis initiative. Na so di President tok, e say make all dis directives start to waka from now-now."


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Thunder storm

    High: 31°C | Low: 24°C