On Air Now

Una Wake Up Show

6:00am - 10:00am

Police Don Order All Police Convoys to obey Traffic Rules

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Di IGP don tok say make all police convoys dey obey traffic rules and regulations.

From now go front, all police convoys go dey obey all di traffic laws with immediate effect. Dis order come from di oga kpata-kpata of Police, wey in name na Kayode Egbeetokun.

Egbetokun tok say e dey very important make eim men dey lead by example and if dem no follow wetin di law tok, police go gbab dem.

Di oga still tok say dem go form special intervention Squad of 40,000 specially trained officers wey go dey on stand by.

Di officers wey dem go select go get beta  training so dem go dey ready for any gbege wey fit happen for any state inside obodo Naija, especially for places wey gbege dey happen wella.

How una see di mata?
#chookmouth

 


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 25°C