Police Arrest Pastor Becos Member Wey Wan See Jesus Fast Till Eim Die

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Kenyan Police don arrest one man wey be Pastor of Good News International Church because eim tell eim followers make dem no chop food or drink water so that dem go fit meet Jesus.

The pastor wey eim name na Makenzie Nthenge carry some of eim followers go Shakahola forest for inside the town of Malindi. Na where dem dey wey eim tell dem make dem no chop or drink water so that dem fit meet Jesus.

Charles Kamau, wey be the criminal investigations chief of Malindi sub-county, don tok say dem don arrest Mr.Makenzie wen dem carry waka enta the forest. Kamau still yarn say dem don carry eleven other followers go hospital wey dem dey collect treatment as three out of dem go need serious treatment.

The policeman still tok say with the way dem dey see the case e be like say more pipu don die for there. 


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny intervals

    High: 38°C | Low: 26°C