On Air Now

Non Stop Music

11:00pm - 6:00am

Nnadozie Don Enter Final List for 2025 FIFA Best Goalkeeper Award

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Super Falcons correct keeper, Chiamaka Nnadozie, don land for the shortlist of the 2025 Best FIFA Women Goalkeeper Award.

FIFA yan say dem don open voting for The Best FIFA Football Awards 2025 on Thursday, November 6.

People wey dey support dem everywhere for di world fit start to vote for their best players, coaches, and goalkeepers on top di official FIFA app.

Nnadozie go dey drag am with big names like Ann-Katrin Berger, Cata Coll, Christiane Endler, Hannah Hampton, Anna Moorhouse, and Phallon Tullis-Joyce for award wey go make  People for everywhere for the world sabi her name for football.

E no go bad if the 24-year-old win, after she show correct form for 2024/25 season with Paris FC — she help dem win Coupe de France Féminine, and she still even join hand make Nigeria carry their 10th WAFCON trophy for Morocco.

The voting go end by November 28, and dem go announce di people wey win for ceremony wey dem go do for the starting of  next year.


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Heavy rain shower

    High: 30°C | Low: 23°C