On Air Now

Closing Joli Joli

6:00pm - 11:00pm

Nine Worshippers Wey Dem Kidnap For Church For Benue Don Dey Free

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Nine worshippers wey gunmen carry comot during midnight vigil for St. John’s Catholic Church for Ojije, Utonkon, don regain their freedom after dem spend one week for kidnappers hand, according to Benue State Police wey confirm am on Sunday.

Dem rescue the victims on Saturday evening after joint operation wey Ado Division and the Inspector-General of Police Intelligence Response Team (IRT) carry out.

Police arrest two suspects, Abubakar Jibril and Ashiru Ibrahim with ammunition for their hand,  dem later pick two more during follow-up raid wey lead to recovery of one AK-47 rifle.

Governor Hyacinth Alia hail security operatives and vigilantes for their quick response.

“The victims dey safe and dem dey receive proper care,” he talk, as e advise residents make dem stay alert and report any suspicious movement.

Authorities say investigation still dey go on to catch other members of the gang, as dem don deploy extra aerial surveillance and tactical teams to boost security across Benue State.


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny intervals

    High: 36°C | Low: 24°C