Nigerian Doctors Dey Ready To Start 5-Day Warning Strike on Wednesday

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Di Nigerian Association of Resident Doctors(NARD),tok say dem go start five-day warning strike on Wednesday

Presido of di join bodi, Dr Innocent Orji,tok dis on Monday wen him dey tok to ofofo join bodi, News Agency of Nigeria (NAN) afta him meeting with National Executive Council (NEC). According to am, di warning strike go start by 8am on Wednesday.

Di join bodi on April 29 bin don give Fedral Government 2 week notice to increase dia salary and all di allowances and dem put dis one for di letter wey dem write to Minister of Health for 2022. 

According to di join bodi, Fedral Government neva review dia CONMESS since 10 years ago, he tok say dem neva call dem come negotiation table since dat time.  

 

How  una see di mata

#chookmouth


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny intervals

    High: 38°C | Low: 26°C