
The Nigerian Bar Association (NBA) don condemn how dem take beat Jennifer Elobor, one NYSC corper wey dey serve for Anambra State. Dem dey call make dem quickly prosecute the vigilante people wey do the thing.
Elobor bin chop beating and dem naked am by security operatives for one incident wey don cause wahala everywhere for Nigeria.
NBA talk say the act na “shameful, wicked, and clear violation of her human rights.”
“Nobody, whether dem suspect say e commit offence or e dey innocent, suppose suffer this kind barbaric treatment,” NBA President, Mazi Afam Osigwe (SAN), yan for one statement wey dem release on Wednesday.
The association still talk say even though security agencies get power to arrest and maintain order, dem suppose use that power the correct way.
“Even if dem wan arrest person, law don already show clear process wey go protect the dignity of the individual,” the statement talk.
NBA still hail Anambra State government say dem quick quick identify and arrest the operatives wey do the thing, but dem insist say accountability gatz go far pass that one.
“Justice no just suppose dey done, e gatz also show say e dey done, to give Elobor justice and also warn others make dem no repeat this kain abuse again,” Osigwe stress.
NBA General Secretary, Dr. Mobolaji Ojibara, add say the Association branches for Anambra and the National Litigation Committee don get order to dey monitor the case well to make sure dem prosecute am correct.
The association still talk say the incident don show say e dey urgent to train and re-orient security operatives so dem go dey respect human rights and show professionalism.