On Air Now

Non Stop Music

11:00pm - 6:00am

Na Market Foces Dey Drive Di New Petrol price- NNPC

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

E be like Nigerians no go get a smooth ride as fuel price go dey increase since fuel subsidy removal.

As we don see, di price don increase from N540 to N617 per liter. Dis one happen on Tuesday morning for Abuja as di NNPC mega station adjust dia pump.

Afta private visit to di Vice President, Kashim Shettima for di State House, Abuja. Di Chief executive Officer of Nigeria National Petroleum Company (NNPC)Limited, Mele Kyari tok say di prices of petrol na di market forces dey control am.

He still tok say NNPC dey get 32 days of supply so di market dey regulate by eimself.

Di Chief Executive Officer of di Nigerian Midstream and Downstream Petroleum Regulatory Authority, Farouk Ahmed,tok say eim agree with wetin di oga of NNPC tok say na di price of crude dey determine wetin fuel prices.

How you see di mata?
#chookmouth


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Thundery shower

    High: 36°C | Low: 24°C