On Air Now

Una Wake Up Show

6:00am - 10:00am

Lagos Man Wey Dey Prison For 11 Years Without Trial Don Free

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

One Lagos State High Court don order say make dem kia kia release one inmate, Mr Maxwell Dele, wey don dey prison for over 11 years without trial. Police arrest Dele after dem call am to ask am question about eim neighbor for shop, Mr James Idem wey dem suspect say join bodi for inside thief-thief mata.

Dele been get shop inside Ikorodu market, Lagos. And James be eim neighbor. When Police dem come dey search for James dem no see am, naim dem say make Dele come answer question about where eim think say James waka go. But when Dele no tell them wetin dem wan hear naim dem arrest am for armed robbery. 

Naso dem transfer Dele go Sagamu Road Police Station, from dia dem transfer am go SARS Ikeja, Lagos, wen eim dey SARs. Dem hang am, come even dey torture am.

Dem use by force make Dele sign  statement wey dem don write down and on October 16, 2011, the same day wey dem charge am with armed robbery for the Magistrate Court 17, Ikeja, Lagos. Dem carry Dele go inside the Medium Security Custodial Centre, Kirikiri, Lagos, and since den eim no appear for in court again for the next 11 years.

Avocats Sans Frontières France (Lawyers without Borders France), Wey be the pipu wey come carry Dele Mata for head. Don come out come talk say this one wey police go dey charge pipu wey dem just suspects with serious offences so that them go fit keep dem for inside prison till when dem like and dem no go try self dey make the case enter court e  need to stop.

According to The Country Director of ASF France in Nigeria, Angela Uzoma-Iwuchukwu, tok say Nigeria Correctional Service data as of October 4, 2021, don show say 70 per cent of the prison population na pipu wey dey wait for dia mata to begin for court.

The ASF country director tok say e pain am say dem just waste 11 years of pesin life becos of the problem wey dey our justice system, she come still say nothing go fit make up for the loss.

 

 


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Thundery shower

    High: 36°C | Low: 26°C