On Air Now

Oga Madam Office

10:00am - 2:00pm

Lagos Don Order Make Dem Begin Check E-hailing Motor Dem Bcos Of Safety Wahala.

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Lagos State Government don tell all e-hailing drivers make dem carry their motor go inspection, so dem fit improve safety, service quality and confam say everybody dey obey the law.

Commissioner for transportation, Oluwaseun Osiyemi, talk say dem don agree do am unto say dem don hear tori say some licensed motors no dey better condition. E warn sey any motor wey dem check con see sey e no good no go work for lagos road again.

Osiyemi talk say government no go allow anything wey go put pipo for wahala as wahala don dey too much. E talk sey all these e-hailing company no get better database and e dey hard to trace any criminal wahala wey fit happen because of them.

Permanent Secretary, Olawale Musa, talk say all driver go register even collect certificate join for Lagos State Driver Institute and if dem no do am, dem go seize their license.

Musa still beg pipo make dem no dey do offline ride so the safety features wey dey the app fit work.


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Light rain

    High: 29°C | Low: 23°C