On Air Now

Kulele Zone

2:00pm - 6:00pm

Lagos CP Don Remove DPO ova Alleged Misbehave For Station

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Di Commissioner of Police, Lagos State Command, CP Idowu Owohunwa, don order di sharp sharp remove of di Divisional Police Officer (DPO), Olosan Mushin, on top alleged misbeave for im station

Owohunwa bin order dis sanction for di officers wey bin allegedly harass one young lady wey bin dey try get justice from di station.

Di command's spokesperson ,SP Benjamin Hundeyin, wey drop dis one for him Twitter handle @benhundeyin, tok say Owohunwa give di instruction after him bin hear from all di pipo wey dey involve for di matter. 

"Because of di many pipo wey dey inside di matter and di need to make sure justice dey, CP Idowu Owohunwa by himself dey interview all di pipo wey di involved. @Lagosdsva community pipo, landlord join body and councilor wey dey represent di area.

"Di committee for di Defence of Human Rights (CDHR) , Omolara and im family, Bebex and di pipo wey dey follow am work, and lawyers wey dey stand for di two sides. 

Hundeyin tok say di police oga, for dis mata, don direct say di Command's Provost to sharp sharp start to deal with di officers wey involve for dis mata. 

"Finally, di Divisional Police Officer(DPO)Mushin, for di division wey all di officers wey dey involve for di mata dey work, dem don comot dem immediate immediate."  

Di News Agency of Nigeria (NAN) report say one married woman wey allegedly dem slap becos she no gree for one man wey dem dey call Babex for Ladipo area of Mushin. 

NAN still report say di lady afta di attack bin make video, wey she dey call human rights activists make dem come fight for am since di Bebex get money.

Wen di mata bin reach Mushin Police Station, some of di policemen allegedly harass and force di lady make she do anoda video tok say she lie for di first video.  
 


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Thundery shower

    High: 36°C | Low: 25°C