On Air Now

Closing Joli Joli

6:00pm - 11:00pm

Lagos APC Happy Say Dem Don Bring Back Monthly Sanitation

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Di All Progressives Congress (APC) For Lagos State don praise di state government As dem bring back di monthly environmental sanitation exercise.

Di All progressive Congress (APC) for Lagos State don hail di state government as dem don bring back di monthly environmental sanitation exercise.

Di party say di move na to show say di government dey “respond and dey responsible” and dem wan protect public health make awa city clean.

For one talk wey dem release on Sunday, The Lagos APC spokesman, Seye Oladejo, talk say di Lagos State government decision go help to keep awa environment clean and ginger resident to join body to clean the community.

Oladejo talk say “di return of the sanitation he show say the government wan protect public health, environmental cleanliness and to allow di community join hand to make the city better to live.

Eim point am out say Lagos na one of Africa fastest growing cities and e need support of di residents to make the environment safe and dey healthy.

Eim talk say as Lagos be one of the Africa most vibrant and megacities wey dey grow fast fast, all the environment need to join hand make am last well.

Oladejo follow remember say di sanitation exercise dey important to teach the people how to keep their area clean.

For many years, di environmental sanitation exercise dey important teach people cleanliness plus civic responsibility. Him add say as dem bring this exercise back, e go make people sabi how to clean, how to throw rubbish and how to maintain drain well.

Di APC spoke person call people, community groups and civil society and organization to support the program.

Oladejo talk say “Environmental sustainability na everybody business, and dis exercise go succeed if everybody cooperate and participate well.

Eim add say di party believe say di policy go help to make Lagos cleaner, healthier and megacity wey go last.


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Thundery shower

    High: 36°C | Low: 23°C