On Air Now

Oga Madam Office

10:00am - 2:00pm

Kaduna-Abuja Rail Service Go Start Work Dis Month

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

The federal government tok say di Kaduna-Abuja rail service go start work dis month.

The Minister of Transportation wey be Muazu Sambo tok dis one on Monday, inside Abuja as him dey yarn ontop wetin di ministry don do from 2015 reach now.

Mr. Sambo announce say di ministry don put better security wey go dey for di rail line, so dat passengers go dey safe and also to protect di rail infrastructure

 

Him no tok di date wey di rail service go start work..

The Kaduna-Abuja line wey close for March, sake of say some passengers die for Terrorist hand and dem kidnapp somes.

All the passengers wey dem kidnapp don come back afta different tok tok and money (Ransome) wey dem pay.


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny

    High: 38°C | Low: 27°C