On Air Now

Una Wake Up Show

6:00am - 10:00am

INEC Don Tok Say Na Abba Yusuf Of NNPP Win Di Governor Chair For Kano

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

The Independent National Electoral Commission, INEC don tok say di New Nigeria People's Party, NNPP governorship candidate, Abba Yusuf na im win di Saturday election for Kano State.

Dem tok dis one on Monday early morning even with di wahala wey dey be like say e won start for di state. 

INEC officer for Kano State, Professor Ahmed Ibrahim tok say di result dey show say NNPP candidate, Abba Yusuf get 1,019,602 votes and APC candidate, Nasiru Gawuna wey dey follow am bumper to bumper get 890,705 votes.

Number of pipo wey register to vote for Kano State na 5,921,370, pipo wey dey qualified to vote inside Kano State na 2,032,955, pipo wey vote correctly inside di state na 1,977,872, and di pipo wey no vote well na 27,092 pipo and total number of di whole votes for inside di state na 2,004,964.

As e be like say wahala won start for di state, Kano State government don tok say dem go get 6am to 6pm curfew until dem go fit arrange law and order back inside di state.

#chookmouth


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny

    High: 38°C | Low: 27°C