On Air Now

Closing Joli Joli

6:00pm - 11:00pm

INEC Don Beg Dia Staff Make Dem No Dey Collect Bribe From People Wey Wan Collect PVC

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

The Independent National Electral Commission (INEC) for inside Abia state don draw hand for ear tell all dia workers say make dem no dey collect egunje (Bribe ) for the hand of people wey wan collect the Permanent Voter Cards (PVCs).


The Oga for wey eim work na to dey follow people  relate for inside INEC office for inside Abia state, Mr Bamidele Oyetunji, tok this one wey eim follow tori people from New Agency Of Nigeria(NAN) tok on Monday.

Oyetunji tok say e no sweet eim belle as eim dey see people dey tok say dia people wey dey work for INEC dey collect money for people hand to give dem dia PVCs.

Eim come still tok say any INEC person wey tell you say dem need money to fit take look for wey your card dey for internet dey lie.

"Anybody wey dem no fit see eim card or get any other issue make dem just go ontop INEC website dem go fit check by dia self."

INEC don carry the PVCs go back to local govt office,  after dem spend about 3 weeks for wards, dey share PVC. 

No forget say dem go stop to dey share PVC by the end of January 2023, so that dem go fit ready for election.
 


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny

    High: 38°C | Low: 27°C