On Air Now

Una Wake Up Show

6:00am - 10:00am

IGP don tok say make dem arrest Seun Kuti becos im beat police officer.

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Di Inspector-General of Police, IGP Usman Alkali Baba,don tell Commissioner of Police, Lagos State Command make im go arrest the Afrobeat singer, Seun Kuti, as im beat police officer wey wear uniform.

CSP Olumuyiwa Adejobi, Force Public Relations officer tok say IGP don order serious chooking of eye for di matter to see wetin cause di beating and the arrest of di offender. 

He  tok say dem no go dey gree for anybody wey no get respect for symbols of authority, say if dem catch you, you must to face the law. 

Afrobeat artiste, Seun Kuti bin show for one video wey dey spread for internet as im dey beat poloice officer wey wear uniform.

He carry go instagram go explain say di officer bin wa kill him and im family members.

How una see am?
#chookmouth


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Thundery shower

    High: 36°C | Low: 26°C