On Air Now

Football Republik

2:00pm - 8:00pm

I Don Rest Well, Now I Ready For Presido Work: Tinubu

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Presido-Elect Bola Ahmed Tinubu, don tok say make pipu no believe the tok-tok wey amebo pipu dey tok say eim no well.

Him say eim dey strong kakaraka and eim don ready to do the work of presido for inside we  obodo naija.

Tinubu yarn this one wen plenty pipu come do am daddy oyoyo for Abuja yesterday Monday. 

If you remember say the presido-elect commot from Naija on March 21 to go relax and chill. But pipu don dey tok say eim no well and na treatment eim go collect.

The tok-tok pesin for Oga Tinubu, Tunde Rahman na eim come tok for say make pipu stop dey tok anyhow say the presido-elect no well, eim dey strong and eim dey ready to work as presido.

To even show say the Presido-Elect don ready to do the work. Eim don dey arrange the pipu wey go follow am work so that once eim siddon for chair everi-everi go dey go smooth, no time for play-play.

Some of the pipu wey come tell am welcome for airport na Vice-President-elect Kashim Shettima, House of Representatives speaker Femi Gbajabiamila and Governor Simon Lalong, Governor Abubakar Sani-Bello, ex-Governor Ali Modu Sheriff, and former EFCC chairman Nuhu Ribadu.

Also deputy national chairman (North) of APC, Abubakar Kyari, deputy national chairman (South), of APc, Emma Enekwu, APC national woman leader, Betta Edu, APC Presidential Campaign Council wey dem don scatta tok-tok pesin, Bayo Onanuga and others


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny intervals

    High: 38°C | Low: 26°C