On Air Now

Kulele Zone

2:00pm - 6:00pm

Gunmen Don attack INEC office, police station, pipo's houses for Anambra.

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Gunmen don attack di office of di Independent National Electoral Commission,(INEC) for Ojoto, for Idemili South Local Government Area for Anambra State.

Pesin wey see as di thing take happen, say di gunmen use Improvised Explosive Devices(IEDs), burn di Commission's headquarters.

Di gunmen also attack a police station and pipo's house wey dey inside di station, kill a boy and wound a girl for Nnobi, for di same local government.

Di talk talk pesin for di police command, DSP Tochukwu Ikenga, bring dis matter for press statement.

Eim say di attack happened on wednesday by 1:45 am, eim say di attackers dey plenty, and dey enter di place wey di thing happen wit four Toyota Sienna Vehicles.

Tochukwu talk say dem don send security personnel around di state to make sure anoda attack no happen again for anoda places. 

Di release read:" Anambra State Police Command today,1/2/2023 don send security deployment for di state, after di attack for di INEC office, for Idemili South, Ojoto and Police Station.

Dem plenty enter with four unmark sienna vehicle loaded with IEDs, petrol bombs and oda weapons by 1:45 am today 1/2/2023. dey enter di INEC office, di police station and di pipo's house wey dey inside the station kill one boy wey dey 16 years, wey be relative to one policeman wey dey serve there and shoot anoda girl wey dey 15 years, she don dey hospital where eim dey receive treatment becos of di wound wey eim get.

#chook mouth#


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Thundery shower

    High: 36°C | Low: 26°C