On Air Now

Una Wake Up Show

6:00am - 10:00am

Gov. Sanwo-Olu Still Keep Eim Chair As Lagos Governor

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

48 hours after the 18th of March 2023 governorship election. The Independent National Electoral Commission (INEC) don tok say na Governor Babajide Olusola Sanwo-olu win the chair of governor inside the state.

The election wey we see plenti report of election gbege, finally end as The Independent National Electoral Commission (INEC) come tok say na Gov. Sanwo-olu na eim win with 762,134 votes, and Gbadebo Rhodes-Vivour of the Labour Party carry second with 312,329 votes,  Abdul-Azeez Adediran aka Jandor siddon for third with 62,449 votes.

Out of the 7,060,195 pipu wey be registered voters for inside the state, only 1,173,631 come out to vote and out of all of dem wey vote, only 1,155,678 pipu votes count the remaining 17,953 pipu votes dey invaild.

After INEC tok the result the governor come out come tok say eim thank Lagos pipu, and say make dem no let  pipu use religion or tribe take cause wahala for the state. Eim come add say after everi-everi  "will come out bigger, stronger and better".

 


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Sunny intervals

    High: 38°C | Low: 25°C