On Air Now

Kulele Zone

2:00pm - 6:00pm

Go Do Gospel Music If You No Wan Smoke-Slimcase

You are viewing content from Wazobia FM Onitsha. Would you like to make this your preferred location?

Nigerian artist, hypeman, and content creator Oluwafemi Oladapo Oko-Eko, wey many people know as Slimcase advise parents say if dem no want make dia pikin wey wan do music smoke, make the pikin just go do gospel music.

Slimcase tok this one when eim siddon tok with Wazobia Fm presenters Adadumdum and Papito inside one episode of dia podcast #ChookMouthGeng.

Ontop the episode of dem been dey yarn about the Naija music industry and how e dey join hand dey support drug culture inside obodo naija.

The codeine diet crooner come yarn say person wey wan dey do worldly music and no wan smoke, be like say you wan do pastor work and no want holy spirit.

Oya watch the full episode of the podcast you fit listen ontop spotify also


Onitsha Weather

  • Onitsha

    Thundery shower

    High: 36°C | Low: 26°C